Site icon ilenkogossipparrot

How Household of David church burn on day special programme suppose begin

Household of David church for Ikeja, Lagos Nigeria don burn.

Di church catch fire di day dem suppose begin a special programme – Mercy Conference 2024.

Lead Pastor of di church Sola Osunmakinde say e bin dey di church on Wednesday morning wen di fire happun and dem watch painfully as everything burn.

“I come in di morning and everything dey ok till we come dey hear say something, fire dey up di roof, e come become bigger, we call fire service but dem no come on time.

Painfully, we watch everything burn completely. Evey seat, AC burn.” Pastor Sola tok.

Pastor Sola add say no life dey lost and say di conference go still begin dat day.

“We thank God say no life dey lost and we thank God for everything. We no dey discouraged and we believe say we go still go on with di conference.

We no dey sad, we dey happy. All things work together.”

Meanwhile, di programme suppose see ministers like Moses Bliss, Dunsin Oyekan and oda pastors like Apostle Joshua Selman, Pastor Yemi David, Pastor Godman Alabi, Pastor Nathaniel Bassey and odas.

Some of dem don send dia support to di pastor.

Pakistan former Prime Minister Imran Khan dey sentenced to prison for leaking state secrets

Exit mobile version