ilenkogossipparrot

Yul Edochie don tok who hin support for election

Nollywood actor wey everibodi sabi who hin name na Yul Edochie don enta sociomedia dey yarn us say na President Bola Ahmed Tinubu wey hin dey support.

D 40 years old movie star con drop pishur wen hin wear cloth wey Tinubu face dey and d thing wey dem write for d bodi of d cloth na “Calm down, Jagaban go make Naija beta”.

Hin open mouth dey hype Tinubu, dey show hin full support for am and hin con tok say he believe say Tinubu go make Naija beta say hin get d capacity. (And dollar dey rise like yeast, dey play).

D actor con add join say hin dey put Tinubu for hin prayers say hin regime go go well.

Naso he take write am;

“ASIWAJU BOY.

100%.

I NO SEND.

I LOVE TINUBU

I CARRY HAND FOR AM

I DEY PRAY MAKE HIN SUCCEED.”

See hin post below,

“My friend sister been marry ghost”- Naija lady dey yarn us

Exit mobile version