ilenkogossipparrot

“My friend sister been marry ghost”- Naija lady dey yarn us

One naija woman don drag pipu attention to her mata afta she know say d man wey she been marry for 2 years wey she get pikin for na ghost.

Dis tori been dey for Twitter from d sister of the friend wey tok say d mata been shock her people dem.

She con explain how d mata been scata scata d kyn marriage and pipu con dey ask questions for d relationship and weda d man identity na true abi na lie.

Na so she take write am:

Today today I don hear wetin my mouth no fit tok. My friend sister don confirm say she marry ghost and dem get pikin(son) togeda. Shey ghost dey real? How he take give am belle? I get many many questions o. Akuko a li mu onu wey mean say Dis kyn tori chop my mouth. Shock don full my body. I been see d family picture. Abeg o I wan ask again how ghost take give woman belle. Before u tok say I wan marry dis person make sure u ask people question o cos ehn. Make u allow your people do research for you make u no go marry ghost o. Hin been want wedding wey small wey 2 or 4 people go come. Dis man con bring people wey hin just know for that state. Hin no bring hin family members. E con be say hin be ghost afta 2 years of marriage and one year old pikin. Abeg dis one pass me”.

See wetin she post;

See how much Davido use buy hin “Timeless” diamond pendant

Exit mobile version