Site icon ilenkogossipparrot

Why Okuama pipo, Govnor Oborevwori no fit access di community of Delta State

Three weeks after di killing of 16 soldiers for Okuama community for Delta State, southern Nigeria, pipo neva still get access to enta or comot for di community.

Dis na sake of military operation wey still dey go on for di community and oda communities wey dey connected to di incident.

For Arise TV, Chief of Defence Staff (CDS), General Christopher Musa, give reasons why residents of Okuama for Delta State not fit get access to dia homes days afta di military take ova di community.

E explain say di military operation dey so serious dat even di govnor of Delta State, Sheriff Oborevwori, no get access to di community becos di security agencies dey carry out a cordon and search operation for di area as dem neva still recova di arms and ammunition of di killed in-action troops.

“We currently dey conduct a cordon and search in di community. Cordon and search operation mean say we dey search evri nook and cranny within di community becos dem get a lot of illegal funds from crude oil theft.

Dem don buy a lot of weapons. So na for us to thoroughly clean di community to ensure say no weapon, no explosive dey left in di community. I fit tell you say at di end of di operation, residents of di community go always go back,” e tok.

Remember say Okuama and Okoloba communities bin don get communal clash wey happun bifor di killing of di military personnel.

On 14 March 2024, youths suspected to be from Okuama working wit some oda suspects allegedly ambush and murder di Commanding Officer of 181 Army Amphibious Battalion, two majors, one captain and 13 soldiers wit one civilian.

Defence Headquarters say dem attack di troops while dem bin dey respond to a distress call wey arise from a clash between Okuama and Okoloba communities for Delta State.

On 28 March, 2024, di military authorities bury di killed soldiers wit honours.

Nigerian President Bola Ahmed Tinubu along with govnors of Delta and Bayelsa States also attend di burial for Abuja, capital of Nigeria.

Following di investigations so far, Defence headquarters don declare eight suspects wanted in connection wit di brutal murder of di military personnel.

Of di eight suspects dem declare wanted, only one of dem, di traditional ruler of Okuama Community don turn imsef in to di authorities.

How to change date of birth by yourself for NIN

Exit mobile version