Site icon ilenkogossipparrot

How to change date of birth by yourself for NIN

National Identity Management commission say Nigerians now fit correct dia date of birth by themselves.

NIMC announce dis new update for dia social media platforms.

Di National Identification Number (NIN) na wetin Nigeria goment dey use establish di identity of every Nigerian.

NIN get 11 non-intelligible numbers wey dey randomly chosen and assigned to one individual once dem finish dia enrolment for di National Identity Database (NIDB).

Dis na eviritin you need to know about how to change date of birth by yourself for NIN.

Date of Birth Self-Service Modification steps for NIN

Afta pesin enrol and collect dia NIN minors and adults alike fit update dia details for dia NIN.

Tins like Name, dates of birth, addresses, etc. fit dey modified. But di date of birth na only once you fit correct am.

Anybody wey wan correct dia date of birth by themselves for Nin go do am online through NIMC self-service NIN modification website.

Once you open di website next tin to do na to follow dis steps

Wit your device you fit do your NIN modification through di self-service on dia website anytime and anywhere

How much to correct Date of birth for NIN?

Di National Identity Management Commission (NIMC) say Nigerians wey wish to correct dia date of birth for dia National Identification Number go pay N16,340.

While to change Name na – N1,522.50 for Address na – N1,522.50 and Email na– N1 522.50

Supporting Documents for Data Modification

Change of Name

Change of Address

Phone Number due to loss or mechanical damage

Police Report

Level of Education

Change of Occupation

Marriage of Ghanaian priest of 63 to 12 year old girl dey cause tok-tok

Exit mobile version