Site icon ilenkogossipparrot

Wetin New York Top court ruling wey overturn im 2020 rape conviction mean for Harvey Weinstein

New York top court don overturn Hollywood mogul Harvey Weinstein 2020 rape conviction, on di basis say e no receive a fair trial.

Di Court of Appeals see say prosecutors bin dey allowed to call witnesses wey dia accusations bin no dey part of di charges against am.

Di ruling say dat mean say dem try am on past behaviour and not solely on di crimes dem bin charge am with.

Weinstein, 72, go remain for prison for anoda separate conviction for rape.

Di court reach a 4-3 ruling on Thursday, say di trial “erroneously admit testimony of uncharged, alleged prior sexual acts against pesins oda dan di complainants of di underlying crimes.

“Di solution for dis errors na a new trial.”

One of di judges wey no agree however say with di decision, “dis Court continue to thwart di steady gains survivors of sexual violence don fight for, for our criminal justice system”.

Accusations against Weinstein begin for 2017 and spark di #MeToo movement, wey expose sexual abuse for di highest levels of di Hollywood film industry and beyond.

E bin face two trials: for New York, wia dem jail am for 23 years for 2020 for raping two women; and for California, wia dem sentence am to 16 years for raping one woman for Beverly Hills hotel.

Di California conviction no dey affected by di decision for New York.

Weinstein currently remain for one prison inside New York. Dem bin extradite am to LA to stand trial.

E go now dey up to Manhattan District Attorney Alvin Bragg, wey na im predecessor Cyrus Vance bring di case, to decide weda to retry Weinstein.

How dis case overturn go affect Harvey Weinstein

Harvey Weinstein still get di 16 years prison sentence from di Los Angeles case so e no dey comot from prison even as dem dey try decide if new trial go happun as per wetin di court order.

Now e go be di decision of Manhattan District Attorney Alvin Bragg to decide weda dem go retry Wein stein.

But e no mean say di lawyers of di case no get opinion of wetin dis mata mean to Harvey Weinstein.

Oga Weinstein lawyer, Arthur Aidala tell di New York Times say dis decision na victory to both im client and “for everi criminal defendant for di New York state”, and hail di appeals court say dem “uphold di basic principles wey criminal defendant suppose get for trial”.

Even as im tok say dem neva tell Weinstein about di ruling.

One lawyer wey bin represent eight of di pipo wey accuse Weinstein say, di ruling dey “tragic” and and na “major step back for holding di pipo wey get hand for acts of sexual violence”.

E add say, “Courts dey normally admit evidence of oda uncharged acts… di jury go get instruction on di relevance of dis kain testimony. Dis go make di victims to endure anoda trial.”

How di New York Case come about?

Weinstein bin dey tried on top five charges for im New York Trial but dem bin find am guilty for only two for 2020.

Di first na di first degree criminal sexual act against one production assistant wey her name be Miriam Haley for 2006. Di second one na third degree rape of one upcoming actress Jessica Mann for 2013.

Even wit di 23 years imprisonment, di jurors find am not guilty for di more serious charges wey include predatory sexual assault, wey for give am even longer prison sentence.

Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

Exit mobile version