Site icon ilenkogossipparrot

Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

Di US Senate don approve bill to ban TikTok ova concern of di kontri national security and manipulation of public debate.

TikTok na one of di most popular social media apps for US. Millions of pipo for US dey use am make funny videos, dance, songs, crazy challenges and news.

For years, US don dey question TikTok ova how dem dey store and use di data wey dem dey collect.

Di lawmakers dey fear say TikTok dey sell di information of ova 170 million US users to di Chinese goment.

On 23 April, 79 senators vote for passing of di bill while 18 senators vote against di bill.

US senate ask di Chinese owner of TikTok owner, ByteDance, make im sell im stake within nine months to one year or dem go block di app for United States.

Now, di senate dey wait for di US president Joe Biden, make im sign di bill into law wen e reach im desk on Wednesday.

Di president wey dey in support of di bill don tok say im go sign di bill wen e reach im desk.

Oda kontris wey don ban TikTok

If di bill become US law, e fit inspire similar laws for oda kontris.

Meanwhile, some kontri don already ban TikTok. India, Iran, Nepal, Afghanistan and Somalia don block di app for dia kontri while Canada, Netherland and United Kingdom don ban goment employees from using di app.

For 2020, India impose ban on TikTok and oda Chinese application companies ova privacy and security concerns. Di ban come afta one clash between Indian and Chinese troops for Himalayan border wey lead to di death of 20 Indian soldiers.

Afghanistan ban TikTok for 2022 on di grounds of protecting di youths from being misinformed.

Canada announce on February 28 say dem go ban TikTok from all goment devices, as di app dey risky to privacy and security.

Di UK goment and Parliament don ban TikTok from staff work devices for 2023 ova concerns on how sensitive goment data fit dey accessible by di platform.

BBC also don advise staff make dem delete TikTok from dia corporate phones becos of security concern.

US ban on TikTok go get ogbonge influence globally but di risk go only affect US becos China don already block access to Chinese citizens from US apps for many years.

Who wan ban TikTok for US and why?

Lawmakers from US don pass bill to ban TikTok unless ByteDance agrees to sell di app to non-Chinese company.

Dis no be di first time American authorities don try to ban TikTok.

For 2020, immediate President Donald Trump bin sign executive order to ban TikTok, but di court block am on di grounds say e dey violate free speech and due process rights.

But Trump – now confam Republican candidate for di 2024 presidential election – don criticise di new legislation, e argue say limiting TikTok go unfairly benefit Facebook.

Di ban of TikTok for US fit cause years of legal fight as ByteDance, owner of TikTok don tell BBC say e go oppose di forceful sales of di company stake for court.

E still fit take years before US goment go fit block di app for di kontri becos of di possible legal action from ByteDance, wey fit delay di process.

Inside one statement on Sunday, TikTok tok say di bill to force di sales of di company go hinder di free speech rights of 170 million US users

Last year, one judge for US state of Montana block one similar ban afta dem find am “to violate di First Amendment

How US wan take ban TikTok?

Di way di US fit ban TikTok na to remove am from app stores by Apple and Google for iOS and Android devices.

App stores na how pipo dey download di app on dia smartphones and tablets, so dem fit stop new users from downloading TikTok.

So pipo wey don already get di app no go fit update am or fix di software.

Di US bill forbid applications control by US adversary kontri from update witin di US border.

Wen TikTok ban fit happun?

Even afta Biden sign di bill, di ban no go take effect immediately.

E go take years before Americans no go fit access di app, as ByteDance law suit fit reach Supreme Court level.

Also, di legislation don give ByteDance nine months to sell TikTok to American buyer, wit additional three-month period, before any ban go take effect.

E mean say di sale deadline go most likely come some time for 2025, afta di winner of di 2024 presidential election take office. If OgaTrump win, e fit block di ban from implementation.

How TikTok dey work and how much of users data e dey collect?

Di heart of TikTok na di algorithm.

Dis na di set of instructions witin di app wey determine di content e go present to users, base on data about how dem don engage wit di material before.

Di app dey offer users three main feeds on dia app – Following, Friends and For You.

Di Following and Friends feed present users wit content from pipo dem don chose to follow and who dey follow dem back, but di For You feed dey automatically generated by di app.

Dis curated feed don become di main destination for users looking for new content, and creators wey dey find millions views for TikTok so videos go fit go viral.

Critics say di app dey collect more data dan oda social media platforms in order to power im highly personalised system.

Dis fit include information about users location, device, di content dem dey engage.

But popular social media apps like Facebook and Instagram dey collect similar data from users.

How TikTok users for Americans react to di proposed ban?

Some US creators and users don criticise di proposed ban.

Tiffany Yu, one young disability advocate from Los Angeles, tell BBC say TikTok dey vital to her work.

TikTok ask di 170 million American users make dem contact dia political representatives and ask dem make dem no support di bill.

Several politicians tok say di campaign don worsen dia concerns about di app and strengthen dia resolve to pass di legislation.

Exit mobile version