Site icon ilenkogossipparrot

UK don ban care workers from bringing dependants – Wetin you need to know

Di goment of di United Kingdom (UK) don issue one new migration policy wey go affect care workers wey dey bring dia families come di kontri.

UK say dis new laws wey comot on 11 March 2024 na to cut migration and tackle care worker visa abuse by oversea pipo wey dey come di kontri.

According to di UK Home Office, all care givers wey go come di kontri go need register if dem dey sponsor any migrants.

According to di Home Secretary, James Cleverly, im tok say care workers dey contribute to dia society but dem no fit dey look plenti abuse and manipulation wey dey happun for di system.

“Care workers dey make helpful contribution to our society, taking care of our loved ones in times of need. But we no fit justify inaction for di face of clear abuse, manipulation of our immigration system and unsustainable migration numbers.”

Cleverly add say e no dey right if dem allow such abuse and manipulation for di immigration system to kontinu.

“We promise di British pipo action, and we no go rest until we deliver on our commitment to bring numbers down substantially. E no dey right or fair to allow dis unacceptable situation to continue.

Di Secretary say dis new plan dey fair as dem dey protect di British workers while pipo wey dey enta di kontri to work and study go add value and grow di UK economy.

120,000 pipo wey arrive last year go dey affected

Di UK Home Office say dem wan cut net immigration – di difference between di number of pipo wey dey go live for di UK and those wey dey comot bin reach a record of 745,000 for 2022. Dem add say e go also help to cut down unsustainable levels of legal migration.

“Care workers no go fit bring dependants, afta a large amount of 120,000 dependants follow about 100,000 workers enta di kontri last year (2023).

Tins wey you suppose do or avoid dis Ramadan period

Exit mobile version