Site icon ilenkogossipparrot

Tins wey you suppose do or avoid dis Ramadan period

Muslims around di world begin dis yearly fast on Monday 11 March as dem enta di number nine month for di Islamic calendar, wey be di month of Ramadan.

Dis year fasting begin on on Monday wey according to di Islamic calendar na di first day of Ramadan 1445 AH.

Inside dis month, Muslims all over di world dey expected to fast from sunrise to sunset, for 29 to 30 days depending on wen dem see di moon.

During Ramadan Muslims dey expected to avoid food, drink, sexual activity and any kain immoral behaviour including tinking wey no pure. So, if you do or tink bad e dey spoil fast di say way wey eating an drinking dey spoil am.

During dis period, di Qur’an ogive permission to believers to eat and drink only from night until di “white thread of light become clear and different from di dark thread of night for early momo.”

Dis na very important period to communicate wit God. Since di month of Ramadan na di month wey Prophet Muhammed (PBH) receive di Qur’an, pipo dey use dis period to recite and reflect on the verses of di holy book.

Na period too for pipo to do charity or zakat. Here rich Muslims dey take care of di needs of di poor.

For im announcement to confam say dem don see di moon, di Sultan of Sokoto remind believers of dis important part of di month wen im say, “We appeal to pipo wey get amongst us to assist di vulnerable and poor wit food and oda items during dis glorious month.”

Although fasting dey compulsory for evri body, e get some legit reasons wey pesin fit no fit fast.

Pipo wey get diabetes especially Type 1, fit no fast becos di long hour between food fit affect dem.

Women wey dey dia period dey forbidden to fast and if dem fast, dem no go get any blessing for am.

Pregnant women and breastfeeding mothers fit no fast or dem fit no do all di fast at once if dia health condition no let dem.

Dis period no be di period to carry anybody for mind. Na time to forgive pipo wey offend you and to ask for forgiveness from pipo wey you offend.

Family and friends gada for Herbert Wigwe, wife and son funeral service

Exit mobile version