ilenkogossipparrot

True true e con be say Kess and Christy O dey kolobi their sef- Nigerians (see full gist)

Sociomedium people don go find old video of BBNaija ex housemates Kess and Christy O wey show say true true dem get one or two togeda.

No be secret again as Kess wife been open their yansh say him and him colleague Christy O dey kolobi eachother and he Dey use her money dey flex with Christy O.

She tok say Kess and Christy O dey do roomate because say dem no fit get better house live for lagos

Wetin con dey vex the wife pass be say anytime wey she call her husband say Christy O always dey there dey wear cloth wey dey show her body. Kess con deny everything wey hin wife tok say he no dey do anything with any of him colleague say hin wife dey insecure and manipulative.

Naso Nigerians con go find video of them wey dem do for tiktok ask Christy O dey ask am wetin she go use d 2k do wey hin give am for hair.

watch video:

https://ilenkogossipparrot.com/wp-content/uploads/2023/10/trim.181C8D21-F6B8-4D98-A397-5351EDA9DEE1.mov

Naija man dey beg nigerians make dem advice am for wetin hin fiancee do

Exit mobile version