ilenkogossipparrot

Naija man dey beg nigerians make dem advice am for wetin hin fiancee do

One naija man dey shocked say hin wife to be don kurukere with five men since nine months wey he go yankee.

The man con enta facebook group dey yarn dem d whole tori say make dem reason the mata drop advice for am. Hin tok say before he travel go yankee say he don already go the girl place go meet her parents dem.

So as he con come back naija after nine months, he con dey feel say the girl don dey follow other men na so she con open mouth confess say yes she don already knack five men since he travel.

He con tok say the girl dey beg am say make he forgive am and now he no sabi wetin he wan do for this mata, weda he go accept am back or serve am better hot breakfast.

See the way he take write am for facebook;

Man don do d unthinkable afta hin babe end their engagement

Exit mobile version