Site icon ilenkogossipparrot

South African artist Tyla beat Davido, Burna Boy, and oda winners for di 2024 Grammys

Davido and Burna Boy lose out for di 2024 edition of di Grammy Awards.

Di two big Nigerian artists lose to South African singer, Tyla, on Sunday, for di award for di Best African Music Performance category.

Apart from Davido and Burna Boy, di female rapper beat oda Nigerian acts including Asake.

Tyla ‘Water’ na im beat ‘Unavailable’ by Davido, ‘Amapiano’ by Asake, ‘City Boys’ by Burna Boy and ‘Rush’ by Ayra Starr.

Di 22 year old, Tyla na South Africa artiste wey don ginger di western space with her brand of Amapiano.

Infact, di level wey she blow reach Nigeria sotay for May 2023, she feature Ayra Starr for one song wey dem call Girl Next Door.

Davido bin tweet afta di event to congratulate Tyla say “Congratulations for your win! Big one for Africa! Keep Soaring!”

Meawhile for Naija, dis one don cause serious gbege on top social media wia pipo don say Nigeria and South Africa go meet again for wetin dem dey call di Amapiano vs Afrobeats battle.

Dis na as Nigeria and South Africa dey play against each oda for di African Cup of Nations semi-finals on Wednesday.

Davido, Burna Boy and oda Africans wey gbab nominations

Davido and Burna Boy bin also dey among di nominees for “Best Global Music Performance” award category wey dem also lose.

World fusion band Shakti win di Grammy for Global Album wit “This Moment”, beating Davido “Timeless” and Burna Boys’ “I Told Them”.

Davido bin gbab three nominations in total for di Global Music Performance, African Music Performance and Global Music Album categories.

Davido and Burna Boy also miss out on di Global Music Performance category wia Burna Boy bin dey nominated for im song Alone and Davido bin dey nominated for FEEL.

Na American artistes Béla Fleck, Edgar Meye and Indian Zakir Hussain featuring Rakesh Chaurasia win di award for dia song, Pashto.

Full List of winners

Best Global Music Performance

Best African Music Performance

Best Global Music Album

Album of the year

Record of the year

Song of the year

Best new artist

Best pop solo performance

Best pop duo/group performance

Best pop vocal album

Best R&B song

Best R&B performance

Best R&B album

Best rap song

Best rap performance

Best melodic rap performance

Best rap album

Best dance/electronic recording

Best dance/electronic album

Best pop dance recording

Best rock performance

Best rock song

Best rock album

Best alternative album

Best alternative performance

Best música urbana album

Best folk album

Best country album

Best country solo performance

Best country song

Best Americana performance

Best Americana album

Best traditional pop vocal album

Producer of the year, non-classical

Songwriter of the year, non-classical

Best music video

Best song written for visual media

Best compilation soundtrack for visual media

Best score soundtrack album for visual media

Best audio book, narration and storytelling recording

Best score for video game or other interactive media

Dr Dre Global Impact Award

Di Grammys create three new categories wey include di Best African Music Performance.

Di award dey to honour recordings wey use unique local expressions from Africa wey show regional musical traditions.

Di genres wey e dey cover na Afrobeat, Afro-fusion, Afro Pop, Afrobeats, Alte, Amapiano, Bongo Flava, Genge, Kizomba, Chimurenga, High Life, Fuji, Kwassa, Ndombolo, Mapouka, Ghanaian Drill, Afro-House, South African Hip-Hop, and Ethio Jazz genres among odas.

Dis dey come wit di success of songs like Calm down by Rema and Water by Tyla wey don give more visibility to African music overseas.

Di nominees for dis category dis year na: Amapiano by Asake & Olamide; City Boys by Burna Boy; Unavailable by Davido featuring Musa Keys; Rush by Ayra Starr; Water by Tyla.

Oda new categories na di Pop Dance Recording and Best Alternative Jazz Album.

Four ways Niger exit from ECOWAS fit affect im relationship wit Nigeria

Exit mobile version