ilenkogossipparrot

Shuuuu! See full gist as pikin use hin papa do money

So-safe corps wey people sabi dem as Ogun state social orientation and safety corps don lock one 20 yr old boy wey hin name na Ridwan for killing hin papa for money ritual.

For press release wey d commander of d corps, Commander Soji Ganzallo thru d office of d director and public relations of d corps, assistant commander Moruf Yusuf, dem tok say around 12:00 for august 31st as dem dey do their normal waka for Oshoku village ijebu north LGA say corp member been hear one kyn noise for one building.

Popo con enta d place con check wetin Dey happen. Like play like play dem see person wey lie for ground as blood full everywer and d person wey kill am don already japa.

Commander Ganzallo con teh ACC Marcus Ayankoya, zonal commander of ijebu zonal command say within 24hrs make dem lock Ridwan for cell. Dem con find am for wer hin dey hide for bush.

Hin con confess say hin kill hin papa with rope con use knife comot d body wey hin go need for d kyn blood money. Con add say hin comot hin papa broktos and four teeth wey d baba kekere been tell am make hin bring.

Dem con ask am wer d baba dey but d boy no gree drop hin location. Ganzallo tok say hin don carry d boy give Nigeria police force, ogbere divisional headquarters for questioning and like this dem fit do anything wey dem wan do giv am.

See wetin mama do hin pikin for Lagos state (Video)

Exit mobile version