ilenkogossipparrot

See wetin mama do hin pikin for Lagos state (Video)

This kyn incident been happen for Badagry inside lagos state as good people con save d pikin after d mama throway am inside river. (This one shock me shuuuuu!)

E get one video wey dem drop for sociamedia wey been show as people dey save d pikin from where d mama dump am make him kpai.

Afta dem con comot d pikin from d water, d man wey save d pikin and oda people wey dey pass con dey try comot d water wey d pikin don swallow tire.

When dem con dey ask d mama question, she con dey do like person wey her head no correct say she life don tire am. She con say d pikin do too live life say dem don do naming ceremony for am say make hin comot for this world. (Omo this one na depression)

As e Dey so d people wey save d pikin don carry am go hospital make him dey alright.

watch video how dem take save am;

https://ilenkogossipparrot.com/wp-content/uploads/2023/09/trim.E7CF2171-DDEB-438C-8910-86845B41C003.mov
https://ilenkogossipparrot.com/wp-content/uploads/2023/09/trim.E6C7BCC5-79A4-4F4D-B79C-16E7B01A72BA.mov

Wetin Actor Bolanle Ninalowo tok today shock internet!

Exit mobile version