Popular Naija artist and activist Folarin Falana aka Falz don open mouth tok say hin been dey get hard times since months now afta hin knee operation.
Una remember say some months wey don go, d singer bin go UK go do surgery afta hin injure when he Dey play ball around November 2022.

Hin con enta hin Instagram dey share video of hinself. He dey gist us how hin bodi be before hin do d surgery and afta hin do am.
E never tay when Falz con go for break so hin go heal wel wel, na hin e con drop video say d healing process dey very painful. Hin say upon all d pain wey he Dey feel say he no go stop and hin go continue to dey try.
D singer don show hin fans and followers love for d support wey dem giv am and for making him dey alright.
Na so e take tok am: “I don see plenty shege dis months wey just pass. Pain plenty. I no go stop to dey try push away all dis pain. I Dey very happy for d love Una don show me. No be lie. E Dey allow me do well and I always dey emotional for my quiet time”.
https://ilenkogossipparrot.com/bbn-nina-don-shame-ilebaye-for-twitter/