Former big brother naija star Nina Ivy don badmouth Ilebaye wey b housemate for d house cos say she bin dey use age insult her friend Ceec.
Una remember say Ceec and Ilebaye bin get quarrel after deir Saturday party ..wey con give Ilebaye two strike and Ceec punishment.

During d kyn fight, Ilebaye con open mouth tok say she be 22 as she wan use her age insult Ceec. Na so Ceec con fire hin own say for 22 she don already get beta things for her life and dem don already call am for Naija Bar.
So because of wetin Ilebaye tok, Nina con enta Twitter con dey throw insult give Ilebaye coz she Dey ageshame Ceec wey b 30. Nina con say she enta biggie house at 21 and she reach finals.
she s she no go dey try kiss al d guys wey for d house for her own time but day she bin stay with one person wey hin name na Miracle till d kyn show bin end. Say Ilebaye no get anything wey she wan use brag.
See wetin Nina write for twitter