ilenkogossipparrot

See wetin Catholic priest tok for video wey women dey pray with wedding gown

Naija catholic priest wey hin name na Father Kelvin Ugwu don tok hin own mind for d video wey trend for sociamedia when women dey use wedding gown dey pray so dem go fit marry before year end.

For d video, d women been wear d cloth make e no be like say dem no get faith for wetin dem dey pray for as dem dey kabash for their husbands.

Dis kyn thing been no make sense for wer this priest dey na why hin con enta hin facebook page dey yab those wey women wey use wedding gown dey pray for their husbands.

Hin say wetin dem dey do dey yamayama and e dey show say dem dey very desperate. Hin con dey loud am make people stop am make e no con be like say na normal thing.

Na how he take tok am for hin facebook page:

“E con be like say na trend and as we dey no dey tok anything and later e go turn normal thing. All those church wey dey tell women make dem wear wedding gown so dem go fit scatter prayer on top their husband head, wetin una dey do no be wetin christians dey do inshort sef na yamayama thing. Which kyn yeye desperstion be that one and why una no dey tell d men dem say make dem wear suit com pray for dem wives? and why una dey wear wedding gown dey pray shey na sign of marriage be that? And those ones wey go rent wedding gown wear come church so e go fit connect dem to their husbands make i ask una as una dey pray for d husband wetin una dey ask God make hin do. Say make hin stop all d choosing choosing for d kyn man wey u want so even as your character and attitude no good say make hin close eyes for wer oda better people dey con marry you?

https://ilenkogossipparrot.com/wp-content/uploads/2023/09/trim.E899E16A-3666-41B4-B51C-3A6B3C4B6D58.mov

I no believe say Wizkid and Burna go dey like this – Ice Prince. Read full gist

Exit mobile version