ilenkogossipparrot

I no believe say Wizkid and Burna go dey like this – Ice Prince. Read full gist

Popular singer wey people sabi as Panshak Zamani aka Ice prince tok say Ayodeji Balogun aka Wizkid and Damini Ogulu aka Burna boy don already see as dem go take be for future.

D 36year old singer been tok say Wizkid don promise am 10 years ago say hin go achieve everything wey hin want for music but Ice prince been no believe am.

D rapper been dey gist us for new episode for afrobeats podcast wey dey hosted by UK based media personality Adesope olajide aka Shopsydoo.

Na so hin take tok am;

”Anytime I see as Afrobeats dey now e go just be like dream wey happen. No be everybody go do am for d same time but na with God and consistency we go do am. I remember when Wizkid been dey tell me say hin go do everything wey hin wan do for music that time wey b 10 years ago and that time I been dey look am like say hin head no correct but see as things take be now. Even Burna boy sef don tell me say hin go do dis one do dat one and den hin no even know how everything go take happen. So as I Dey see everything dey happen e con be like say I Dey watch feem. Las las dream dey happen sha. I Dey proud of dem. I follow for people wey go tell u say I been see dem Wizkid and Burna grow.”

Naija man dey yarn us wetin hin see inside food wey hin chop for burial

Exit mobile version