ilenkogossipparrot

See how much Davido use buy hin “Timeless” diamond pendant

Popular Naija singer David Adeleke aka Davido don buy timeless diamond pendant for more than 500 million naira.

D musician been post d time when hin buy am for hin Instagram page.

D diamond pendant wey dem keep for safe was brought out so d singer go fit test am as e Dey for one video wey hin post for IG.

Dem make d kyn pendant make e Dey like Timeless, hin ogbonge album. D pendant Dey like hour glass with plenty small small diamonds wey dem put inside am.

Davido been tok say hin change sand to diamond after hin see how d pendant take be, wey come make people wey dey there begin laugh.

From people wey dey always tok tok, dem tok say d pendant na €500,000 wey be plenty million for naija money

See wetin do Bobrisky papa

Exit mobile version