ilenkogossipparrot

Peter Obi don explain tire but evidence no gree show say he win election- Tribunal

Presidential election petition court don confam say Labour Party and their person wey be Peter Obi no win election as dem no get evidence.

As Justice Abba Bello Mohammed drop leading judgement, tribunal tok say d things wey Labour Party tok say the party wey win do no be true say all of dem na lie and LP no get strong evidence to support wetin dem tok. LP say dem scata scata d votes of people wey dey imo, rivers, benue, taraba and osun.

The thing wey spoil everything be say dem no sabi d ghan ghan polling unit wey dem say APC do magumagu for. Omo this this country sha na only God fit help us laidis.

Court con tok say Peter Obi and hin party say dem win and na dem get d highest vote but dem no sabi d exact number of votes wey dem use take win d other parties.

The main thing wey fit make u win election na numbers. Na so court take tok am.

Justice Mohammed con add say LP fail to drop evidence say other parties been dey over vote na why LP vote no plenty.

See wetin Catholic priest tok for video wey women dey pray with wedding gown

Exit mobile version