One naija sisi don drop message for men wey no dey pursue woman upandan say e go hard dem to follow another woman when dem dey relationship or when dem don marry
For one video wey she share, she tok say any man wey no b woman wrapper fit don dey under juju.

According to wetin she Dey tok, she say normal man suppose dey cheat on hin woman and hin suppose don do am before. if dem know say dem no dey do am, she say dem dey under correct juju.