ilenkogossipparrot

Man don do d unthinkable afta hin babe end their engagement

Naija lady don enta sociomedium dey yarn us how her four bedroom house and bar been take catch fire after she cancel her engagement with her bobo.

So according to the lady, she tok say she been find d guy when she been dey build her house say he follow for engineer wey dey build d house. Later dem con dey relationship wey con make d guy give am ring.

She tok say things con turn upside down after she no gree stay with the man wey dey stay for rented one room house when she get four bedroom house. He con force am say she must come stay with am. Na so she con tell the man she no dey marry am again.

The man con tell am say she go regret wetin she jus tok. Later later her house wey she use money build and the bar business wey she Dey do con catch fire from top to bottom. Nawa o

See wetin Naira Marley tok since after Mohbad die

Exit mobile version