ilenkogossipparrot

Miracle don happen as Virgin Mary eye turn red for church

Members for church for Mexico tok say dem see statue of Virgin Mary dey cry as water dey comot for hin eye and even the sef turn red join.

This kyn thing wey neva happen before con dey draw people mind even people wey dey go church and people wey no dey go. The thing happen for El Chanal as plenty people con dey enta the church dey check weda na true Abi na lie.

Videos wey dem post for sociomedium show as water dey comot for the Virgin Mary eye.

Person wey dey live for the community wey hin name na Ramos tok say “as we Dey cry, our eyes go turn red. Na the same thing dey happen to the image. Na so tears begin flow from the Virgin Mary eye. This na the thing wey dey happen for this church”

People sef follow add say the tears na because of the insecurity wey dey the area wey dey even cause katakata upandan.

Victor one of the people wey dey for the church con add say “them go link to tears to wetin dey happen for Colima and even for the community”.

BBNaija star Bella don reply fan wey ask am wetin she go do if Sheggz no marry am.

Exit mobile version