ilenkogossipparrot

BBNaija star Bella don reply fan wey ask am wetin she go do if Sheggz no marry am.

Reality Tv star Bella Okagbue don drop ansa for one of her fan wey ask am say wetin she go do if Co-star Sheggz no marry am.

If una remember well say Bella and Sheggz been meet for inside Big Brother naija house and since that time dem still Dey kampe.

Bella don Dey yarn for sociomedium since day she too love Sheggz and she no go fit leave am even as plenty tok tok been wan scatter their kyn relationship as dem comot for Bbn house.

As their love still Dey grow dey jolly, one fan con ask am question for Q&A say if Sheggz no marry am afta everything wey dem don do togeda say wetin she go do.

Na so the fan take write am “Bella if Sheggz no marry you shey u no go vex afta everything?”.
Bella con give am ansa back say her and Sheggz no gum bodi togeda say if things go one way say she go move on. She con say shebi people dey get ex na, say her own no go dey different.

My wife no sabi cook and she Dey call my mama winch- Man dey para

Exit mobile version