Site icon ilenkogossipparrot

Marriage of Ghanaian priest of 63 to 12 year old girl dey cause tok-tok

One ogbonge traditional priest wey be 63 years old don marry one 12-year-old girl for Ghana.

Di mata don cause serious gbege for Ghana as plenti pipo dey tok about am.

Di priest name na Nuumo Borketey Laweh Tsuru XXXIII and im marry di girl for one customary way. Di customary ceremony bin happun on Saturday.

As plenti gbege dey go on and pipo dey criticise di action wey di priest take, di community leaders tok say di pipo no understand dia customs and traditions.

Di legal minimum age wey pesin fit get married for Ghana na 18 years and child marriage don reduce, but e still kontinu to dey happun.

Di videos and photos of how di event bin go begin dey spread ontop social media and e show how community members bin come out in large numbers.

Di videos dey trigger anger and many Ghanaians dey show say dem no agree for dat kain marriage between di priest and di small girl wey shele on Saturday.

During di ceremony, some women bin dey speak local language Ga to tell di girl say make she dey dress to seduce her new husband.

Dem also dey advice her to dey prepared for wife duties and make she dey use di perfumes wey dem give her so go fit dey sexually attractive to her husband.

Di statements of di women bin vex pipo wey see say di marriage no just be ceremonial.

Some pipo dey call on authorities make dem break di marriage and investigate di priest Mr Tsuru.

‘Na purely tradition and custom’

Di leaders for Nungua indigenous community wey di girl and and di priest belong to tok say those wey dey condemn di marriage dey tok from di ‘point of ignorance’.

Nii Bortey Kofi Frankwa II, wey be local community leader, say di role of di girl as wife to di priest na “purely tradition and custom.”

Im add say di girl don start di rites to become wife to di traditional priest six years ago and e no affect her education.

Di girl dey expected to undergo second ceremony wey go purify her for her new role as di wife of di high priest.

Di ceremony go also prepare her for marital responsibilities wey go include child bearing, according to local tori.

Oga Tsuru na “Gborbu Wulomo”, one traditional high priest for di Nungua indigeneous community for Ghana capital, Accra.

Who be di 63-year-old priest?

As spiritual leader, di priest dey among di highest-ranking traditional leaders for di community.

Na im dey perform sacrifices on behalf of di community, im dey pray for di protection of di community and im dey enforce cultural practices.

Na di priest dey also lead traditional rites during events even di installation of traditional chiefs for di community.

Goment authorities neva respond to di marriage of di 64-year-old priest and 12 years old girl wey dey vex plenti pipo for Ghana.

Ghanaian law recognise customary marriages, but no allow say make child marriages dey happun under di tok say na culture or tradition.

According to di global campaigning NGO Girls Not Brides, 19% of girls for di count for Ghana dey marry bifor dem reach 18 and 5% of dem dey marry bifor dia 15th birthday.

How eight years old girl survive bus accident wey kill ova 40 pipo for South Africa

Exit mobile version