Nigerian lecturer for university of port harcourt don go extra mile commot expo for attendance wey dem dey take for class.

For one video wey dem post for tiktok by people wey dey PH, d lecturer been dey use fingerprint machine dey collect attendance for class so people no go dey sign for anoda person. (wahala no dey ever finish)
D video show as d lecturer dey waka for class dey tell d students make dem put hand for d machine so e go fit collect their fingerprint.
UNIPORT lecturer enta class with fingerprint machine
D students sef do wetin d lecturer teh dem say make dem do and even do am dey jolli as d lecturer dey jejely wait make all of them do d kyn process.
People wey con see d video con tok say wetin d lecturer do na better thing say magu magu students been dey write their friends name wey no dey class for inside d attendance book.
Some people con tok say even with d whole fingerprint gragra say people go still kona kona their way do wetin dem wan do.
Real warri pikin don yarn us how she take loss weight (video)