ilenkogossipparrot

Real warri pikin don yarn us how she take loss weight (video)

Naija comedian Anita Asuoha aka Real warri pikin don yarn us how she take lepa overnight.

She been cause traffic for sociamedia after she post when she Dey lepa and con promise people say she go teh dem how she take do am.

See pictures of how she be before and now;

So recently she con drop one video wey she agree say yes she do weight loss surgery because say d overload wey she carry before no good for health.

According to her she tok say her husband sef put mouth tell am say make she do the kyn surgery say d weight dey affect her health.

Na so she take write am;

So na Ikechukwu (hin husband) Dey teh me say make I do surgery coz hin no wan make I die. Omo d thing hard me o, na around that kyn January 2023, I go cry I go go gym I go dey chop small small food, eye go dey turn me coz say I no chop wetin my body want. e con dey hard for me coz d only solution na to do surgery so I go lepa and Dey well. I con say make I try do am naturally but people wey dey around don already conclude say I must do surgery. Omo I no go lie u e hard me ghan. Las las I con man up tell my husband say I Dey ready for d surgery. Na d most hardest decision wey I don take for this life. I con go d kyn weight loss surgery.”
Like this now she say she dey very happy say she do d surgery cos as e be so all d health katakata wey she dey get don comot. She say she no dey feel d headache, knee pain wey doctor tell am say she get.

Warri pikin con write;

“I Dey happy say I been take this kyn decision. I happy say my husband, doctor and my family say make I do d surgery say I go dey alright. I don do am and I Dey kampe. I no dey wake up with headache or say my eye dey turn me and d pain wey I get for body don go. I Dey free now and I Dey very good now”.

See video where she Dey tok wetin happen;

See wetin BBNaija Frodd say he go do for single maale

Exit mobile version