ilenkogossipparrot

Make una see wetin evil people take do with missing FUOYE student

100 level student of Federal university of Oye Ekiti wey her name na Atanda Modupe Deborah don finally show after two days wey she comot lost.

E con be say Modupe wey dey nursing department stream A for faculty of basic medical science been loss after she go night class for inside school on Monday 4 September 2023.

As she go since and never come back from d night class wey she go, her roommates dem con dey worried say true true she don lost.

Omo na so dem see Modupe body wey dem bury for ground for back of her faculty building on Wednesday 6 September and her eyes no dey her body again.

As d mata take be, the university registrar Mufutau Ibrahim con drop message on Wednesday evening say make all d students for the school comot go house sharp sharp.

The university administration con tok say dem don already call army people say make dem cover everywhere for security and dem con put camera for d school for extra security.

Laidis now dem tok say plenty people don Dey arrested as e take concern wetin happen to the student.

Na so d statement take be

”The university management don hear news about d case of Modupe Deborah who been lost on Wednesday 6th September and d whole management no dey happy for thing wey happen. We wan tell una say d university community don Dey do their best concerning the issue wey dey ground as national security personnel sef don shook eye for d mata. Popo don carry plenty people enter cell as all of dem na suspect.

To stop all this katakata, all d students wey dey stream A and other student wey dey do full time for d school say make dem park comot make dem fit do d investigation.

The university go do everything dem go fit do till dem catch d criminals and dem go face the result of wetin dem do. New resumption date go come out soon and we Dey sorry for d adjustment say make una no vex”.

Peter Obi don explain tire but evidence no gree show say he win election- Tribunal

Exit mobile version