Phyna wey b BBNaija season 7 winner don call our ogbonge singer Davido because of wetin hin do for Twitter.

She call am out bcos say he been like one post for Twitter wey dey yamayama her name.
Phyna con dey confused as she no know why and wetin she do Davido wey go make am put potopoto for her face laidat.
As the gbasgbos stil dey happen, she still hail am for d twins wey hin born and she con still ask am why he Dey hate on am.
The whole thing been start when Davido like tweet wey yamayama her name.
One Twitter influencer been tok say anybody wey dey Stan celebrities like Phyna say all of them dey show sign say dem dey useless. Naso Davido con go like the tweet.
So as Phyna con drag am out, he con reply am;
People wey dey intanet con dey laugh and while some people dey confused as the whole gist con dey fly upandan.
Plenty people con see Davido answer as yab and dem con advice Phyna say make she relax say make she focus on things wey get better value and make she no dey expect too much.
Some sef believe say Davido dey cap and he Dey chase clout say how he no go fit sabi say Phyna dey exist.
Wahala no too much?!!!
Singer Ayra Starr dey thank God say she no dey wer she Dey before she make am