Site icon ilenkogossipparrot

How South Africa parliament speaker enta gbege of 12 counts of corruption

South Africa former Speaker of Parliament Nosiviwe Mapisa-Nqakula don enta gbege as dem charge am wit 12 counts of corruption and one count of money laundering.

She bin make her first court appearance afta she waka by herself go police station for Thursday morning.

Di ex-speaker dey face accuse wey include say she bin dey request for bribes bifor she go award contracts during di time wey she be defence minister.

As di mata dey go, she bin deny say she do dat kain tin for court. She say she no do any wrong and she no fit commit crime.

“I no get di behaviour to dey commit crime.”

Di prosecutor, Bheki Manyathi , bin tell di Magistrates Court for Pretoria say dem get “enough evidence” against Ms Mapisa-Nqakula.

Dem release her on bail.

Afta some weeks wey investigations start, Ms Mapisa-Nqakula bin resign on Wednesday. Her resignation no mean say she admit say she dey guilty.

She tok say as di investigation bin dey serious, she no fit kontinu wit her work again for di role wey she dey handle.

President Cyril Ramaphosa on Thursday tok say Ms Mapisa-Nqakula suppose dey commended for her decision to resign.

“We need recognise say her level of integrity for our democracy don make her do dis,” e tok.

Last month, some special police unit bin go scatter her home for Johannesburg sake of di corruption case wey dem link her to as dem dey investigate.

Ms Mapisa-Nqakula accuse na say she dey make demands for money, wey reach up to $120,000 (£96,000) from one company.

Di owner of di company wan secure permission to dey transport army equipment back to South Africa from anoda place for Africa, according to wetin local tori Business Day newspaper.

Di 67-year-old woman wey dey strong for her voice for di anti-apartheid struggle bin become speaker for 2021.

Bifor she become speaker, she don serve as defence minister for seven years.

Last week, Ms Mapisa-Nqakula lawyers bin file one request for court say make dem no fit order her arrest. Di lawyers say di arrest go affect her dignity.

But sadly, di judges bin reject her request sake of say di matter no dey urgent and dem no fit tok ontop arrest wey neva happun.

Her resignation from her role dey come wen di general election for di kontri go happun and many pipo dey tok say e fit affect di African National Congress (ANC) wey dey rule currently.

Why Okuama pipo, Govnor Oborevwori no fit access di community of Delta State

Exit mobile version