Site icon ilenkogossipparrot

How soldier wey mob beat to death get justice after seven years

Afta seven years of trial, one high court for Ghana finally sentence twelve pipo wey kill one soldier, to life imprisonment.

Di convicts chop accuse say dem attack di Captain, Maxwell Mahama for Denkyira Obuasi for di central region .

Di high court find dem guilty of conspiracy to commit murder and murder.

Dis na afta a seven-member jury finish dia work wia dem tok say di twelve pesin all be guilty.

Assemblyman for Denkyira Obuasi, William Baah dey among di pesin wey chop life imprisonment.

Di odas na Bernard Asamoah, Akwasi Baah, Kwame Tuffour, Joseph Appiah Kubi, Kofi Nyarko, Michael Anim, Emmanuel Badu, John Bosie, Akwasi Baah, Charles Kwaning and Kwadwo Anim.

Two oda pesin don waka free afta di court find say dem no dey among di crime.

Dem be Bismark Donkor and Bismark Abanga.

Di fact of di case as e don comot for court be say di soldier be di commander for di military detachment for di community.

Di 31-year-old soldier wey write promotion exam at di time, bin dey wait promotion to di rank of major.

Captain Maxwell Adam Mahama im papa also na retired soldier.

Tori be say im also marry for 2012 wia dem get two pikin.

Information for court show say on 29 May 2017, di soldier wear civilian shirt wit im sidearm leave im base wey im go dey jog.

Reports be say as im stop dey buy foodstuff for roadside, one of di vendors don see im side arm.

Na so she call di assembly man William Baah for phone top wia im report give am say im see pesin dey carry gun dey waka di area.

Prosecution for court tok say, afta di call, assembly man no verify di gist, wia im mobilize pipo for di area say make dem attack di soldier.

Di prosecution add say “di mob meet captain Mahama for di Denkyira Obuasi cemetery wia dem beat am well-well.”

Dem never give am chance say im go explain imsef.

“Di mob use sticks, stones, clubs, cement blocks and machetes take beat am. Dem also pour petrol wey dem burn part of im body.”

Many years afta di incident, oga for one inter-ministerial committee on illegal mining, Professor Kwabena Frimpong Boateng tok say na di soldier and di detachment dey protect one mining concession for di area.

At di time, many pipo tok say di pipo for di area no try.

President Akufo-Addo give order wia dem give di deceased soldier state burial for December 2019, two years afta di mob kill am.

Di president also direct say make dem build one monument to remember am.

Im also direct say make dem set up a Captain Maxwell Mahama memorial trust fund wit GHC 500,000 ($41k) seed moni to take care of im wife and pikin.

Di president don take im personal moni of GHC 50,000 ($4k) take put inside dat fund at di time.

“Di pipo wey kill di soldier never go go free, dem go face di law,” di president bin assure di family.

Na so di president also announce say dem promote di late soldier posthumously from captain to major.

Civil society groups and oda sabi pesin beg di soldiers say make dem no storm di community for revenge.

As di mata blow up, some of di locals bin run leave di community sake of dem dey fear say di soldiers go come afta dem.

For ordinary Ghana pipo, dis incident na dark chapter for di history of di kontri.

Many pipo tok say dis for be di last time pipo go use mob action take punish pesin.

Wetin we know about Richard Adeoriokin – di US Associate Professor wey die of accidental discharge for Osun state

Exit mobile version