ilenkogossipparrot

BBNaija winner Ilebaye don yarn us wetin she go use the money do

Ilebaye Odiniya wey b BBNaija winner don drag people eye for her mata as she been yarn them as how she go take spend the 120m wey she win.

The 22 year old star wey con win the ogbonge money and one better tear rubber don shock people with the way she wan take spend d money.

When people been ask am about the money and how she wan take run am, her answer con melt people heart come make people like am pass. Instead say she go tok say she go use the money dey lavish am but she con remember where her faith dey. Naso she con tok say she go carry 10 percent of the money wey b 12m give for tithe for her local church.

Naso she take tok am: “As soon as d money land for my account, the first thing I go do na to carry some give God for tithe. Use am thank God for the good grace wey he don show me”.

To Dey give tithe na strong thing for Christian people and even Ilebaye understand am wella. As she give God her tithe money, she Dey try honor her faith and thank Baba God for all hin blessings for her life.
This young star way don shake plenty people even people wey love her and her fans dem but some people still get their own tok for the mata as d thing wey she wan do no good for them.

True true e con be say Kess and Christy O dey kolobi their sef- Nigerians (see full gist)

Exit mobile version