ilenkogossipparrot

Pat Attah don finally open mouth tok wetin sup with hin and Genevieve Nnaji

Popular actor Pat Attah don drop full gist of hin two year love love with Genevieve Nnaji and how e take end.

Hin say hin date d actress for two years before dem con comot for d kyn relationship coz of wahala wey dem dey get for d relationship.

Afta dem con ask am weda d relationship dey hidden, hin con deny am say d relationship dey serious and hin dey proud of am.

people wey see dem for dat time sabi say dem dey serious relationship since Pat don tok say dem dey waka go places.

Deir relationship dey only 2 years before e con scatter dem con say make dem go deir own way

na so hin tok am “I no go lie we bin get better thing and we Dey serious. But for some kyn reason we con break up coz of one or two. True true e be like d relationship last around 2years. No be hide hide relationship we bin go places togeda”

https://www.yabaleftonline.ng/dated-genevieve-nnaji-only-two-years-pat-attah-opens-break-up-with-actress-video/

Exit mobile version