Site icon ilenkogossipparrot

Answers to five questions about di brutal killing of sojas for Delta state wey shake Nigeria

Di Nigerian Army don reveal say di killers of about fifteen sojas for Delta state bin murder dem in cold blood and also rip out dia hearts from dia chests.

Di Army add say dia troops bin dey on peaceful mission to calm one reported case of communal clash between Okuama and Okoloba communities in Ughelli South and Bomadi LGAs of Delta State but e no end well.

Dis incident don draw reactions from d number one man for Nigeria wey give di go ahead for di Army to carry on with a full investigation to fish out di perpetrators.

Many questions dey as to why and how dis mata happen.

We try to ansa some for dis tori.

Who be di gang wey kill di sojas?

According to Major General Onyema Nwachukwu wey be di Director of Army Public Relations, na armed youth gang of Okuama community murder di troops and e be like say na coordinated attack of dia sojas.

Di Army Director of Public Relations tok say dis gang wickedly murder sojas afta dem lay ambush for dem.

“Di unfortunate killing of troops of 181 Amphibious Battalion of di Nigerian Army (NA), wey dey on a peaceful and mediatory mission, na act wey everybody need to condemn.

“Dis na troops wey dey committed to peace and security of lives and property of citizens and non-citizens for di Niger Delta Region but an armed youth gang of Okuama community murder dem in cold blood.”

Di incident happun on Thursday, 14 March wen some community youths ambush sojas wey bin dey respond to one crisis between Okuama and Okoloba communities for Delta state.

For di attack, one Commanding Officer, two Majors, one Captain, 12 sojas and one civilian die.

“Dem go ahead to wickedly devalue di remaining bodies by ripping out dia hearts – di very pipo wey dem wan go protect – for di most gruesome, heartless and cruel manner.”

“Dis dey clear say di murder of di troops na communally orchestrated attack against legitimate forces. Di lie to deceive di public to cover up di criminal acts of di armed youth gang no go work and dem must dey ready to face di wrath of di law.”

Although di army tok say dem no go do any reprisal attack but entry into di community dey blocked according to report and search don begin to arrest di gang wey carry out di evil act.

BBC Pidgin fit confam say di army no allow movement ontop di river for di communities as at di time of filing dis report.

Who be di sojas wey dem kill?

According to di Nigerian Army wey share di sojas photo on X, di gang kill di personnel and also rip out dia hearts.

Di names and ranks of di sojas wey dem kill:

Wetin di sojas go do for di community?

According to reports, di army bin dey invited to chook mouth inside di gbege wey dey happun between Okuama and Okoloba communities.

Di army say dia troops bin go for ‘peaceful and mediatory mission’, afta dem receive report of cases of communal clash for Ughelli South and Bomadi LGAs of Delta State.

Di men of di Nigerian Army bin go Okuama community for peace tok wey go make di crisis end.

According to di statement wey di Acting Director, Defence Information, Tukur Gusau issue, e say some community youths surround and kill di military personnel wey bin dey on a peace mission go Okuoma community for Bomadi Local Government Area of Delta state.

Wetin cause crisis for di two communities

For January 2024, serious gbege begin dey happun wen Okoloba community of Bomadi local goment and Okuama of Ughelli South local goment areas of Delta State bin dey attack diasef.

Reports say wetin cause di gbege be say dem dey fight ova land issue wey involve trespass into dia fishing area.

Di two communities no gree for diasef and since 2023, dem don dey call on di state goment make dem come settle di wahala.

Di chairman of di Okoloba community, Mr Clement Koki, bin tok say di pipo of Okuama dey stop and search dia pipo ontop di river.

Mr Clement tok for February say Okuama pipo dey threaten to drivers wit gun say dem go kill any Okoloba pipo wey dem find ontop di river.

Di two communities begin dey fight ova fishing areas as dem threaten diasef with guns.

Even afta di state goment bin call for meeting between di two communities on 6 February 2024, di mata neva end.

For early 5 March 2024, local media report say dem kill one young man from Okoloba community afta di youths of Okuama bin ambush and drown am for river, sake of dia ongoing land dispute fight.

Chairman of Okoloba community say di youths for Okuama reportedly carry di young man to dia village square to beat before dem come dump am for river on 9 February.

Civilians die for di attack?

One oda question wey pipo dey ask na if civilians lose dia lives for di attack.

Army say one civilian die but some pipo tink say e fit be more.

Wetin go happun next

Several prominent pipo including di president say dem go get to di root of di mata.

Di Chief of Army of Staff, Lt Gen Toareed Lagbaja, say no stone go dey unturned until di perpetrators of di acts don face di full wrath of the law and dem no get any hiding place.

Di senator wey dey represent Delta North for di National Assembly, Ned Nwoko don give assurance say those wey dey responsible for di death of di sixteen sojas go dey identified and brought to justice.

President Bola Tinubu also give di Defence Headquarters and Chief of Defence Staff full authority to bring to justice pipo wey dey responsible for di tragic killing of officers and sojas for Delta state.

Di Nigerian leader for statement say those wey commit di crime no go-go unpunished.

BBC Pidgin gather say plenti pipo dey try run from di community but di military no allow boats to move ontop di river and movement of unauthorised pesins dey restricted for di community as search for di perpetrators continue.

‘I dey die for DSS hand’ – Nnamdi Kanu pull shirt for court say make dem transfer am to prison

Exit mobile version