Site icon ilenkogossipparrot

Akwa Ibom-based lawyer wey allegedly brutalise im wife chop arrest

One lawyer don enta police net afta video catch dey beat im wife.

Di Akwa Ibom State Police Command say dem arrest di lawyer say e allegedly brutalise im wife.

Di incident happen for dia house for Ewer Housing Estate, Uyo di Akwa Ibom State capital and di viral video show how e bin dey beat im wife becos of key and im neighbours dey confront am say e don dey beat her lok dat for di past four years.

Di video wey don go viral show wia e dey beat im half-naked wife wit wounds wey dey bleed until di neighbours stop am from di assault.

For statement, Police tok tok pesin SP Odiko MacDon say dem no go allow di abuse of human rights na im make di Commissioner of Police Akwa Ibom State, CP Olatoye Durosinmi order di arrest of di lawyer to prevent murder and breakdown of law and order and assure say di suspect go get im day for court.

Di CP also warn pipo wey dey involved in violent crimes to stop such tins and urge family members to try resolve any disputes amicably instead of resorting to violent attacks.

Meanwhile di Nigerian Bar Association Uyo Branch say dem don set up investigation panel to chook eye into di mata wey involve dia member.

Chairman of di Branch, Augustine Udoh tok say dem condemn any act of brutality especially as e dey di viral video.

Udoh say di investigation panel go invite both di man and im wife to find out wetin happun as part of dis preparation for disciplinary actions wey relevant committees of di NBA go take.

For statement wey di NBA Uyo Branch tok tok pesin Ndi Aquaisua sign say di leadership of di NBA bin first verify di video and cinfam am to be real and condemn di action of di man.

“Without prejudice to ongoing further investigative activities and potential disciplinary procedures by relevant Committees of NBA, we wish to roundly condemn di dastardly act of violence and abuse as e show for di video. E dey despicable and totally unacceptable and must be condemned by all well meaning members of di society.

Di legal profession hold dia members to high standards of learning and character.

Di NBA Uyo Branch truly dey scandalized by di misconduct wey dey evident for di video.”

Dem say dem go join bodi wit relevant groups and agencies of goment to fight against domestic violence and indeed all forms of violence against pesins.

Minister of Women Affairs, Uju Kennedy Ohanenye bin don order for im arrest and say even if di wife decide say she no wan sue di man sake of family pressure, di man must face di law as justice must be served.

Wetin be Dengue fever wey don infect some pipo for Nigeria

Exit mobile version