ilenkogossipparrot

Wetin be Dengue fever wey don infect some pipo for Nigeria

Di Nigeria Centre for Disease Control and Prevention (NCDC) don confam say Dengue fever don infect some pipo for Sokoto state nNrthwest part of di kontri.

According to di World Health Organisation Dengue fever na virus infection wey dey spread from mosquitoes to pipo.

“NCDC dey aware of outbreak of dengue fever for Sokoto State. So far, 71 suspected cases, 13 confirmed cases and zero deaths dey reported for di state.”

“Currently, di virus dey reported for three local goment areas Sokoto South (60 cases), Wamako (3 cases) and Dange Shuni (1 case),” statement from NCDC tok.

Di centre say dem do everything necessary in collaboration wit oda agencies on di mata and also add say di issue dey moderate level for Nigeria since na only Sokoto out of 36 states get di disease.

Even for Sokoto na 3 out of 26 local goment Dengue happun and no severe disease and death so far,” di statement add.

Finally dem tok say di kontri dey prepared to respond to large scale infection in case e happun.

Di World Health Organization don classify dengue virus as one of di top ten global health threats.

E be one of di fastest spreading mosquito-borne diseases. At least half of di world population dey at risk of infection.

Like chikungunya virus, Aedes aegypti and Aedes albopictus mosquitoes na im dey spread dengue.

Both viruses share dey di same control interventions and non-specific symptoms of headaches, a rash, fever and muscle and joint pain, so most often e dey misdiagnosed.

Most human cases of dengue dey asymptomatic or present wit mild symptoms, wey dey last for two to seven days.

For certain individuals, dengue virus dey develop to severe disease and symptoms include persistent vomiting, bleeding gums or nose and enlarged liver.

E must dey treated as medical emergency as these complications fit dey deadly.

Dengue virus fit dey diagnosed using a rapid diagnostic test or a polymerase chain reaction (PCR) test but no treatment dey available.

One vaccine don dey developed and few kontris don approve am for use but e neva dey widely available in Africa at present.

Dr Usman Qalbusunnah na medical doctor for Rigasa General hospital for Kaduna state (Northwest Nigeria) and e tok say how to avoid Dengue virus infection na to use same tactics wey pesin dey use to avoid malaria.

“As you know na mosquitoes dey cause Dengue fever so na to use same tactics wey pesin dey use to stop malaria.”

Some of di methods include using mosquito nets and also clearing stagnant water and dirts from immediate environment.

Na mosquito dey cause Dengue fever.

Doctor say make pipo use Malaria prevention tactics to stop Dengue fever.

Exit mobile version