• Login
ilenkogossipparrot
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
ilenkogossipparrot
No Result
View All Result
Home Nigeria

Wetin we know about Richard Adeoriokin – di US Associate Professor wey die of accidental discharge for Osun state

Sisi Eko by Sisi Eko
January 29, 2024
in Nigeria
0 0
0
0
SHARES
1
VIEWS
Share on FacebookShare on TwitterShare on whatsapp

Osun State Police command don confam di arrest of Ejigbo prince as dem dey conduct investigation ova di death of Richard Idowu, wey pipo sabi as Adeori Okin for Osun State.

Police tok say di incident shele around 9:00 pm for Ejigbo, Osun state on Saturday.

Oga Idowu wey be associate professor for Prairie View A&M University for United State, die during im visit to di Ejigbo prince for di 50th coronation celebration of King Oyeyode Oyesosin Ogiyan of Ejigbodi for Osun state on Saturday.

Osun residents reportedly kill di security guard, Hammed Abdul Jelili wey fire di gun wey kill Adeori Okin as e dey try to run comot afta im gun accidentally kill di Associate professor.

Inside one press statement, di tok-tok pesin for Osun police command, Yemisi Opalola, confam say di prince order one of im security guard Hammed Abdul Jelili make im fire di double barrel gun into di air to confam if di gun dey work, na im di gun accidentally kill di victim.

Di police tok-tok pesin confam say dem don detain prince Eniola Oyeyode wey give di instruction as dem dey investigate di matta.

“Di prince Eniola Oyeyode wey give di order to im civilian guard make im fire di gun, don dey arrested and detained.

“Di State Commissioner of Police, Bzigu Dali Kwazhi, don beg members of di public especially di residents of Ejigbo make dem remain calm as investigation don begin immediately.”

Govnor Ademola Adeleke of Osun State order police make dem conduct investigation into di death of Richard Idowu.

Di governor say make security agencies prevent any possible counter-attacks of violence for di community afta di sad incident.

Oga Adeleke also deploy delegates to pay peace settlement visit to Ejigbo as im dey appeal to di family of di deceased make dem no take laws into dia hands.

Di delegate members include; commissioner of police, commissioner for chieftaincy and local goment affairs, commissioner for information and special adviser to di govnor on Security.

Adeori Okin na associate professor of statistics for department of mathematics for Prairie View A&M University in United State.

Oga Idowu graduate from University of Ilorin wit B.Sc. in Mathematics for 2003.

Im travel go United States to further im education wia im obtain Masters degree in Mathematics and Statistics from Louisiana State University for 2009.

Oga Idowu begin im career as lecturer for Louisiana Tech University for 2009 and since den e don teach undergraduates and graduates in Mathematics and Statistics courses both at Louisiana Tech University and Praire View A & M University.

In 2012, Idowu obtain im doctorate degree in Computational Analysis and Modeling from Louisiana Tech University.

E dey currently work as assistant professor of Mathematics and Statistics for Praire View A & M University, Houston Texas, im start to work wit di university for 2016.

Also, Oga Idowu na ogbonge politician for Osun state -im na member of Peoples Democratic Party afta im commot from All Progressive party in 2022.

How pulling out of Ecowas go take affect Mali, Niger, Burkina Faso

Tags: NIGERIAOsun State
Sisi Eko

Sisi Eko

Related Posts

Nigeria

New minimum wage and oda highlights of Tinubu Democracy Day speech

June 12, 2024
Nigeria

Push for six-year single term for president, govnors – wetin lawmakers wan achieve

June 11, 2024
News

Labour unions outline grounds for suspending nationwide strike as dem tok wetin go happun next

June 5, 2024
Facebook Twitter Youtube Instagram
ilenkogossipparrot

We provide you with the latest breaking news and videos straight from the entertainment industry.

Follow Us

Category

  • News
  • Entertainment
  • Music

Recent News

Hunter Biden: US president Joe Biden only surviving son go go jail?

June 12, 2024

New minimum wage and oda highlights of Tinubu Democracy Day speech

June 12, 2024

Push for six-year single term for president, govnors – wetin lawmakers wan achieve

June 11, 2024

Plane wey carry Malawi vice president don miss

June 11, 2024

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Welcome Back!

Login to your account below

Forgotten Password?

Retrieve your password

Please enter your username or email address to reset your password.

Log In

Add New Playlist

No Result
View All Result
  • Home
  • News
  • Politics
  • Business
  • Entertainment

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Are you sure want to unlock this post?
Unlock left : 0
Are you sure want to cancel subscription?
Go to mobile version