Popular naija singer, Zlatan been drop hin last message with hin late paddie, Oladips for sociomedium small time before hin kpai.
If una remember say dem announce hin death yesterday afta he been get medical emergency wey dem no gree tell us wetin been do am.

Zanku master con finally open up say he Dey very sad as he don lose hin paddie wey hin start hin music journey with.
Zlatan Ibile con add say he been dey pray for am say make he hear good news about hin health before their last tok. Na e he con share their old picture when dem still Dey hustle.