• Login
ilenkogossipparrot
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
ilenkogossipparrot
No Result
View All Result
Home Nigeria

YouTube delete Emmanuel TV Channel of disgraced mega church leader TB Joshua

Sisi Eko by Sisi Eko
February 1, 2024
in Nigeria, People
0 0
0
0
SHARES
1
VIEWS
Share on FacebookShare on TwitterShare on whatsapp

YouTube don terminate di official channel of disgraced Nigerian televangelist TB Joshua megachurch say e violate dia hate speech policies.

Dis dey come weeks after one investigation by di BBC and openDemocracy uncover evidence of widespread sexual abuse and torture by di late preacher.

Emmanuel TV bin play a key role for im rise from a local pastor to global star.

TB Joshua die for 2021, but as for im church, Synagogue Church of All Nations (Scoan), na im wife Evelyn Joshua dey run am now.

Di church neva still comment on di removal, but dem bin don tok say previous allegations of wrongdoing dey “unfounded”.

Emmanuel TV bin get more dan half a million followers on YouTube and hundreds of millions of views.

Dis na di second time in three years wey dia YouTube channel dey suspended, following previous breach of di platform community guidelines.

As part of di investigation wit di BBC, openDemocracy bin analyse Emmanuel TV online presence, come find out say at least 50 “abusive” videos dey on YouTube.

Dia team report di videos to YouTube and di account come dey suspended on 29 January.

For one comment to di BBC, di Google-owned video-sharing platform say Emmanuel TV dey “terminated for violating… hate speech policies”.

TB Joshua bin get fame for im “healing” ministries and dem film hundreds of services wey claim to show how e dey cure di physically disabled and chronically ill – wey many former church members don subsequently debunk say no be true.

Di content wey openDemocracy report bin include Emmanuel TV footage of pipo with mental health issues wey dem keep in chains, cases of medical misinformation and examples of smear campaigns against women wey speak out about TB Joshua sexual abuse.

Emmanuel TV satellite channel also dey dropped on 17 January by MultiChoice, a South African company wey dey run popular satellite services DStv and GOTv.

For many years, di channel bin be one of di most successful Christian networks for di world, and e dey broadcast to millions all over di world.

Following di publication of di BBC investigation into TB Joshua, a number of contributors dey trolled by church and Emmanuel TV affiliated accounts online. These accounts also dey reported to YouTube by openDemocracy, but dem never remove dem.

YouTube and oda social media platforms don come under intense scrutiny in recent years over dia online safety policies.

How shutdown by Bureau de Change go take affect naira to dollar exchange rate

Tags: TB JoshuaYouTube
Sisi Eko

Sisi Eko

Related Posts

Nigeria

New minimum wage and oda highlights of Tinubu Democracy Day speech

June 12, 2024
Nigeria

Push for six-year single term for president, govnors – wetin lawmakers wan achieve

June 11, 2024
News

Labour unions outline grounds for suspending nationwide strike as dem tok wetin go happun next

June 5, 2024
Facebook Twitter Youtube Instagram
ilenkogossipparrot

We provide you with the latest breaking news and videos straight from the entertainment industry.

Follow Us

Category

  • News
  • Entertainment
  • Music

Recent News

Hunter Biden: US president Joe Biden only surviving son go go jail?

June 12, 2024

New minimum wage and oda highlights of Tinubu Democracy Day speech

June 12, 2024

Push for six-year single term for president, govnors – wetin lawmakers wan achieve

June 11, 2024

Plane wey carry Malawi vice president don miss

June 11, 2024

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Welcome Back!

Login to your account below

Forgotten Password?

Retrieve your password

Please enter your username or email address to reset your password.

Log In

Add New Playlist

No Result
View All Result
  • Home
  • News
  • Politics
  • Business
  • Entertainment

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Are you sure want to unlock this post?
Unlock left : 0
Are you sure want to cancel subscription?
Go to mobile version