Site icon ilenkogossipparrot

Woman wey kill makeup artist for Enugu go die by hanging

Enugu State high court don sentence one Chiamaka Ifezue to death by hanging sake of di murder of one woman – Ijeoma Nweke – for November 2020.

Ijeoma Nweke na makeup artist wey Chiamaka Ifezue call make she come do job for am, but she come vanish and police later find her deadi bodi for roadside afta some days.

Police later use di phone number wey call am to trace until dem arrest two pipo, Ms Ifezue and her brother Chukwuemeka and charge dem wit murder and conspiracy to commit murder.

For court on Wednesday, Justice Kenneth Okpe wey handle di mata tok say im find di accused guilty of killing di deceased as she force am to drink poisonous substance, wey lead to her death.

Dem bin charge Ms Ifezue under Section 274(1) of di Criminal Code Law of Enugu State, and di punishment na death sentence as punishment.

As e dey deliver di judgement, di judge tok say Ms Ifezue look gentle for face but she get “a heart of steel”.

“She no show any remorse from di beginning of trial to judgment day. I hereby sentence di defendant, Ifezue Chiamaka, to death by hanging until she die. May God have mercy on her,” Justice Okpe tok.

But Justice Okpe bin discharge her brother, Chukwuemeka, afta im agree wit di defence lawyer say di prosecution no present any evidence to show say im follow commit di crime.

Di tori bin generate a lot of interest wen e happun for 2020.

For November 11, 2020, Ijeoma Nweke wey be makeup artist get one call from a potential client for a home service job, but as she go di job, nobodi see her again.

Her pipo go report to police who later declare di girl missing. But on November 16, five days after, pipo see Ijeoma deadi bodi for road.

As police start investigation, dem begin track di number wey bin call Ijeoma for dat home service job, and na so dem take arrest Ifezue Chiamaka and her brother Chukwuemeka come charge dem to court.

Ijeoma na graduate of Imo state university wia she bin study psychology, before she later become makeup artist.

Wen di tori of her death comot, a lot of Nigerians bin react and call for justice.

Popular Big Brother star, Mercy Eke bin tok say both of dem na classmate for school, and dat di girl bin graduate wit 2.1.

Latest in Senegal afta yawa gas say President Macky Sall postpone presidential election

Exit mobile version