• Login
ilenkogossipparrot
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
ilenkogossipparrot
No Result
View All Result
Home Lifestyle Health

Why court convict cosmetic doctor Dr Anuoluwapo Adepoju

Sisi Eko by Sisi Eko
May 18, 2024
in Health
0 0
0
0
SHARES
1
VIEWS
Share on FacebookShare on TwitterShare on whatsapp

Di Federal High court don convict one medical doctor Dr Anuoluwapo Adepoju sake of say she fail to appear bifor di commission.

Di court convict Dr Anu as pipo take sabi am, sake of say she no gree appear bifor di Federal Competition and Consumer Protection Commission (FCCPC).

Di mata be say Dr Anu refuse to honour dia invitation for one investigation ontop accuse say her medical services dey cause injuries to customers, according to FCCPC.

Tori be say di Federal High Court wey sit for Lagos State bin convict Dr Anu of di five-count charges wey FCCPC bin sama her ova failure to present documents wey dem request from her.

Di prosecution also tok say Dr Anu no show up for di summon wey FCCPC sama her to appear for di commission in April 2020.

Dis mata don begin since 2020, as FCCPC bin arrest Dr Anu ontop accuse say she no cooperate wit investigation into allegation of anyhow medical practice.

Dr Anu na di founder of MedContour Services Ltd, and she enta gbege for 2020 wen different pipo bin accuse her say surgery wey she do for dem dey cause dem more injuries.

Sadly, one of Dr Anu client wey her name be Nneka Onwuzuligbo bin die in 2020 sake of wetin tori say dey linked to di surgery wey she do.

Dat time, na Irukera dey head FCCPC wey dey handle customer complaints for Nigeria.

On Friday 17 May 2024, Irukera confam for im X page say dem don convict Dr Anu and her medical practice.

“Today na a day of pride for me say I personally prosecute Anu Adepoju and her medical practice. Though don comot, di case bin end in a conviction,” Irukera write.

Di court bin sentence her to one year imprisonment, or make she pay N100,000 as fine, according to local media ChannelsTV.

I no be plastic surgeon- Dr Anu

Dr Anu wey follow BBC News Pidgin tok for 2020 say she no be plastic surgeon as pipo dey refer to am. She say na cosmetic surgeon she be and she dey focus on liposuction.

“To sabi do cosmetic surgeon, di basic requirement na MBBS. I go for certificate course and I dey certified to practice cosmetic surgery,” Dr Anu tok dat time for 2020.

Omotola Taiwo wey pipo sabi as ‘Omohtee’ share details wit BBC Pidgin for 2020 of how di cosmetic surgery wey she do don affect her mentally, physically and financially sotay she bin dey reason to kill hersef.

Di 28-year-old open up about di different fluids wey dey comot from her bodi and di pains wey she still dey feel six months afta her surgery.

Omohtee wey bin do ‘top up’ liposuction and Brazilian Butt Lift surgery as far back as January, 2020 for Lagos, Nigeria bin come out to accuse her surgeon, Dr Anu Adepoju say she do failed surgery for her wey don cause her serious health complications.

Dr Anu wey dey sue Omohtee for N25 million ontop defamation charges, also share her own side of di tori, dat time.

She bin insist dat time say she be qualified Doctor and Cosmetic Surgeon wey don train wit different ogbonge medical institutions and claim say she get over 1,000 successful surgeries to her name.

By dat time, di goment don lock up her clinic.

Wetin happun bifor

For July 2020, di Federal goment of Nigeria bin arrest one Dr Anu of  Medcontour and charge her to Federal High Court, Ikoyi, Lagos.

On Friday, 4 July 2020, Federal Consumer Protection Council (FCCPC) announce di arrest of Dr Anu ontop accuse say she no cooperate with investigation into allegation of medical anyhow practice.

Dr Anu and her company bin don trend for social media many times over di last two years wen pipo go comot to accuse am say di cosmetic surgery she do ontop dia breast or bumbum come make dem worwor, or cause dem serious injury.

She don always comot to deny di accuse.

On 15 April 2020, authorities close Medcontour office for Lagos ontop accuse of “illegal activities” and say investigation go begin.

According to informate wey FCCPC release for july 2020, dis arrest and criminal charge na because Dr Anu no comply with di commission requirements for di investigation and say she no give dem di informate dem ask her for.

Oga of FCCPC wey dey incharge dat time Babatunde Irukera, wey imsef na lawyer, na di lead prosecutor for di case.

Tinubu appoint governing council members for Federal institutions – wetin be dia work?

Tags: Cosmetic surgeryDr Anu
Sisi Eko

Sisi Eko

Related Posts

Health

‘I wan live long, but e dey expensive’ – high cost of drugs hit patients for Nigeria

May 21, 2024
Health

‘We dey like blind pipo’ – Di community for Enugu wia pipo dey live inside lack

May 13, 2024
Health

Dem get 200,000 pipo wey dey live wit HIV but dis kontri dey on di path to be first for Africa to eliminate mama-to-pikin transmission

May 6, 2024
Facebook Twitter Youtube Instagram
ilenkogossipparrot

We provide you with the latest breaking news and videos straight from the entertainment industry.

Follow Us

Category

  • News
  • Entertainment
  • Music

Recent News

Hunter Biden: US president Joe Biden only surviving son go go jail?

June 12, 2024

New minimum wage and oda highlights of Tinubu Democracy Day speech

June 12, 2024

Push for six-year single term for president, govnors – wetin lawmakers wan achieve

June 11, 2024

Plane wey carry Malawi vice president don miss

June 11, 2024

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Welcome Back!

Login to your account below

Forgotten Password?

Retrieve your password

Please enter your username or email address to reset your password.

Log In

Add New Playlist

No Result
View All Result
  • Home
  • News
  • Politics
  • Business
  • Entertainment

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Are you sure want to unlock this post?
Unlock left : 0
Are you sure want to cancel subscription?
Go to mobile version