• Login
ilenkogossipparrot
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
ilenkogossipparrot
No Result
View All Result
Home Nigeria

Who be Omobayo Godwins – govnor Obaseki new deputy?

Sisi Eko by Sisi Eko
April 10, 2024
in Nigeria, Politics
0 0
0
0
SHARES
1
VIEWS
Share on FacebookShare on TwitterShare on whatsapp

38-Year-Old Omobayo Marvellous Godwins don take oath of office as di new deputy govnor of Edo State, south-south Nigeria.

Edo State chief judge swear am in as di new deputy govnor of di state afta di impeachment of Philip Shaibu, di immediate past deputy govnor.

Plenty pipo witness di oath of office wey hold for di Edo State goment house.

Govnor of Edo State, Godwin Obaseki bin appoint Godwins as deputy govnor of di state.

Dis dey come afta di state House of Assembly on Monday 8 April impeach Shaibu.

mobayo na 38-year-old Electrical Electronics Engineer wey get experience in di oil and gas sector.

Im bin bin contest as Labour party candidate for Federal House of Representatives seat of Akoko-Edo Federal Constituency during di 2023 elections.

Edo State House of Assembly impeach Shaibu afta e refuse to honour invitations by di seven-man panel wey investigate allegations against am.

Afta im refusal, di panel wey Justice S.A. Omonua (rtd) bin lead write report wey recommend im removal, say Shaibu no take di opportunity to defend imsef.

For dia sitting on Friday, Justice Omonua lament about di former deputy govnor absence say, “dis na di position of di panel. Di panel adjourn sitting to today (Friday) for di last time for di respondent to present im defence, and di respondent still no come bifor di panel.”

Lawyer to di former deputy govnor, Professor Oladoyin Awoyale (SAN) bin don withdraw from participating in di proceedings afta di panel rule against im motion as e ask di panel to comply wit Federal High Court Abuja wey order di panel to show why dem no go grant injunction to maintain status quo till dem determine di mata before dem.

Tins begin fall apart between Govnor Obaseki and ex-deputy Govnor Shaibu wen Shaibu show interest say im wan succeed Obaseki for di 2024 election.

Di gbege begin dey happun wen informate reach di public say im no tell di govnor about di decision.

One of di many tins wey happun for back between di Edo State govnor and im ex-deputy na wen Shaibu waka comot of one goment event afta dem force im aide out of di hall.

Di drama happun during di colloquium wey hold at di Sir Victor Uwaifo Creative Hub wey dem use mark di 60th-anniversary celebration of di Midwest Referendum.

On anoda occasion, security operatives bin stop di ex-deputy govnor as im wan try reach di govnor during di church service wia dem dey mark di 32nd anniversary of di creation of di state.

Di drama dey surprising to pipo as di security no allow Shaibu greet Obaseki and oda dignitaries wey come di event.

Later, accuse wey tok say di ex-deputy govnor leak official goment secret also arise as di panel wey chook eye for di mata bin want make e defend imsef against dis allegation but e no show for di time dem invite am.

Shaibu come file case against im boss for Federal High Court. But by 5 September 2023, e withdraw di case sake of say some prominent pipo for di state intervene.

Na crime to get ambition?

Di former deputy govnor of Edo State Philip Shaibu don tok say im denounce di “illegal impeachment” wey di House of Assembly member forcefully impose.

Shaibu tok dis inside one video for im Facebook page afta im impeachment as di state deputy govnor on Monday, 8 April.

E tok say dis no be just attack on am but attack on di democratic principle and threat to democratic process for di state.

E tok say di move dey dangerous and e fit lead to dictatorship

Di former deputy govnor tok say di impeachment dey harsh becos im dey ambitious to contest for di upcoming election as di govnor of Edo State.

“Make e dey clear say di impeachment dey hard becos of my ambition to contest di Edo State 2024 govnorship election under di PDP,” Phillip Shaibu tok.

“Ambition wey be legal to all citizens of di Federal Republic of Nigeria. Na sad reality for our political landscape say dem dey resist ambition and pipo wey dey power dey seek to silence opposition through illegitimate means.”

Di former deputy govnor tok say im don dedicate im life to serve di pipo of Edo State and work tirelessly to improve di life of di pipo but instead im dey faced wit baseless accusations.

E add say di allegation wey im face na just to cova for dia true motive to impeach am comot from office and na betrayal to di trust wey pipo of Edo State get im dia political leader.

How EFCC recova N30bn from poverty minister investigation

Tags: Edo State
Sisi Eko

Sisi Eko

Related Posts

Nigeria

New minimum wage and oda highlights of Tinubu Democracy Day speech

June 12, 2024
Nigeria

Push for six-year single term for president, govnors – wetin lawmakers wan achieve

June 11, 2024
News

Labour unions outline grounds for suspending nationwide strike as dem tok wetin go happun next

June 5, 2024
Facebook Twitter Youtube Instagram
ilenkogossipparrot

We provide you with the latest breaking news and videos straight from the entertainment industry.

Follow Us

Category

  • News
  • Entertainment
  • Music

Recent News

Hunter Biden: US president Joe Biden only surviving son go go jail?

June 12, 2024

New minimum wage and oda highlights of Tinubu Democracy Day speech

June 12, 2024

Push for six-year single term for president, govnors – wetin lawmakers wan achieve

June 11, 2024

Plane wey carry Malawi vice president don miss

June 11, 2024

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Welcome Back!

Login to your account below

Forgotten Password?

Retrieve your password

Please enter your username or email address to reset your password.

Log In

Add New Playlist

No Result
View All Result
  • Home
  • News
  • Politics
  • Business
  • Entertainment

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Are you sure want to unlock this post?
Unlock left : 0
Are you sure want to cancel subscription?
Go to mobile version