Site icon ilenkogossipparrot

Who be di eight pipo Nigerian Army declare wanted sake of Okuama soldiers murders

Di Nigerian Army don declare eight pipo wanted sake of di killing of soldiers for Okuama community of Delta State on 14 March.

For dia X page on 28 March, di Army publish photos of di wanted pipo wey dem dey find in connection to di killings wey shake di whole kontri.

Nigeria Chief of Defence Staff, Major General Christopher Musa bin earlier tok say di Nigeria Army sabi who dey responsible for di killing of 17 soldiers from 181 Battalion wey bin go peace mission for Okuama community for Delta State.

For one press briefing wey di CDS give, e bin tok say dem kill Lieutenant Colonel A.H. Ali and im men sake of say im bin dey try end illegal oil bunkering wey dey happun for di Niger Delta creeks.

“We sabi who do dis tin, we dey follow am up, and na just a mata of time, we sure say we go get am,” General Musa bin tok.

E say many of di militants wey dey do oil bunkering dey get plenty weapons and na one of di ones wey dey benefit from am na im kuku use di opportunity of di fight between di two communities to kill Lt. Col. Ali.

According to Major General Onyema Nwachukwu wey be di Director of Army Public Relations, na armed youth gang of Okuama community murder di troops and e be like say na coordinated attack on dia sojas.

Professor of physics and seven odas wey dey wanted

One of di names wey dey di list, Ekpekpo Arthur, na professor of Physics for Delta State University, Abraka.

Anoda name for di list na dat of one young man wey video of wia e bin claim responsibility for di incident bin spread for social media.

Di release of di suspect names dey come hours afta di Nigerian Army bury di soldiers for Abuja on 27 March.

President Bola Tinubu wey attend di event wit oda dignitaries tok say leaders for Delta State gatz fish out killers of di soldiers.

Di slain soldiers collect honours in three categories wey include Member of the Order of the Niger, Federal Republic Medal I, and Federal Republic Medal II.

President Tinubu order di military to pay di slain soldiers’ benefits to dia family members within 90 days.

Di federal goment give di families of di slain soldiers houses, and dia children get scholarships.

How di killings bin happun

On Thursday 14 March some community youths bin ambush sojas wey bin dey respond to one crisis between Okuama and Okoloba communities for Delta state.

Tori be say di gbege na sake of say dem bin dey fight ova land issue wey involve trespass into dia fishing area.

Di two communities no gree for diasef and since 2023, dem don dey call on di state goment to come settle di wahala.

Di Army Director of Public Relations Major General Onyema Nwachukwu bin tok say dis gang wickedly murder sojas afta dem lay ambush for dem.

“Di unfortunate killing of troops of 181 Amphibious Battalion of di Nigerian Army (NA), wey dey on a peaceful and mediatory mission, na act wey evribodi need to condemn.

“Dis na troops wey dey committed to peace and security of lives and property of citizens and non-citizens for di Niger Delta Region but an armed youth gang of Okuama community murder dem in cold blood.

“One Commanding Officer, two Majors, one Captain, 12 sojas and one civilian na dem bin die for di attack,” Nwachukwu tok.

Wen be South Africa 2024 elections and wetin dey at stake for di ANC?

Exit mobile version