• Login
ilenkogossipparrot
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
ilenkogossipparrot
No Result
View All Result
Home News Politics

Who be di APC, LP, PDP candidates for Edo govnorship election?

Sisi Eko by Sisi Eko
February 23, 2024
in Politics
0 0
0
0
SHARES
3
VIEWS
Share on FacebookShare on TwitterShare on whatsapp

Di Edo State govnorship election na one of di off cycle elections wey go shele for 2024 and candidates don emerge for two of di leading political parties for di state, di All Progressives Congress and di Labour Party.

Govnor Godwin Obaseki tenure go come to an end for November afta eight years of piloting di affairs of di state.

Monday Okpebholo wey be di senator representing Edo central emerge as di candidate of di APC, while di former national chairman of di Nigerian Bar Association (NBA), Olumide Akpata win di LP govnorship primary election for di state.

Meanwhile, na two candidates emerge for di Peoples Democratic Party (PDP) and dis one mean say e neva dey clear who dem go put forward as di pesin wey go represent dem for di election.

Deputy Govnor Philip Shaibu and ogbonge lawyer Asue Ighodalo na di two candidates wey emerge for di PDP govnorship primaries.

Di govnorship election for di state go shele on 21 September 2024.

Monday Okpebholo – APC

Monday Okpebholo beat 11 oda aspirants to emerge candidate of di APC for di November 21 election.

Govnor Bassey Otu of Cross River state and chairman of di APC supplementary primary election declare Okpebholo winner of di election on Friday, for Benin.

Otu tok say di candidate poll 12,433 votes to defeat 11 other aspirants for di primary election.

E tok say di breakdown na 31,863 accredited voters, total votes cast na 31,863, valid votes na 31,863 and na zero invalid vote dey for di primary election.

Olumide Akpata – LP

Olumide Akpata bin score 316 votes to win di LP govnorship primary wey shele for Benin, di Edo State capital, on Friday 23 February.

Na di deputy govnor of Abia State Ikechukwu Emeta declare Akpata as di winner of di election.

“I hereby declare as follows: Mr Olumide Osaigbovo Akpata, having scored di highest number of votes and certified di provisions of di constitution of di party, don dey declared di winner and di gubernatorial candidate of di Labour Party for di Edo State govnorship election 2024,” Emeta tok.

Asue Ighodalo or Philip Shaibu? – PDP

Di govnorship candidate of di PDP for Edo State still neva clear sake of say na two candidates emerge.

Deputy Govnor Philip Shaibu and ogbonge lawyer Asue Ighodalo bin emerge as candidates for two different primaries.

Shaibu bin emerge candidate of di party for one primary. But Ighodalo emerge di candidate of di party for anoda primary where im defeat oda aspirants wit 577 votes including Shaibu wey bin score one vote.

Na Govnor Dauda Lawal of Zamfara State wey be di chief returning officer of di Edo PDP govnorship primaries declare Ighodalo as winner.

“Di Committee having carefully sorted out and counted di votes find say Ighodalo score 577 votes, Philip Shaibu score 1 vote, while odas get zero,” e tok.

Sorrow, tears and pain as Akeredolu make im final journey home

Tags: APCEdo StateLPPDP
Sisi Eko

Sisi Eko

Related Posts

Politics

Ireland, Norway, and Spain to recognise Palestinian as state

May 22, 2024
People

Di Ghana 2024 elections registration wey dey target 623,000 new voters

May 9, 2024
People

New constitution dey threaten election of President Faure Gnassingbé wey im family don rule Togo for over 57 years

April 29, 2024
Facebook Twitter Youtube Instagram
ilenkogossipparrot

We provide you with the latest breaking news and videos straight from the entertainment industry.

Follow Us

Category

  • News
  • Entertainment
  • Music

Recent News

Hunter Biden: US president Joe Biden only surviving son go go jail?

June 12, 2024

New minimum wage and oda highlights of Tinubu Democracy Day speech

June 12, 2024

Push for six-year single term for president, govnors – wetin lawmakers wan achieve

June 11, 2024

Plane wey carry Malawi vice president don miss

June 11, 2024

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Welcome Back!

Login to your account below

Forgotten Password?

Retrieve your password

Please enter your username or email address to reset your password.

Log In

Add New Playlist

No Result
View All Result
  • Home
  • News
  • Politics
  • Business
  • Entertainment

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Are you sure want to unlock this post?
Unlock left : 0
Are you sure want to cancel subscription?
Go to mobile version