One former Nigeria Exchange Group Chairman, Bamofin Abimbola Ogunbanjo dey among di pipo wey die for di helicopter accident wey happun for America on Friday, 9 February.
Di helicopter crash also claim di lives of di Access Holdings Group Chief Executive Officer, Herbert Wigwe, im wife, son and two oda crew members.
National Transport Safety Board (NTSB) for one briefing on Sunday on top di helicopter accident tok say, di Airbus Helicopters EC-130 crash for California near di Nevada border.
NTBS say dia investigation on top di helicopter accident on Sunday tok say di Airbus Helicopters EC-130 crash for California near di Nevada border.
One NTSB board member, Michael Graham and one investigator, Aaron Sours wey dey in charge of di incident bin provide details on di helicopter wey crash.
Dem tok say witness reports suggest say rain dey fall wen di helicopter crash.
“Witness reports to di weather condition at di time of di accident suggest rain plus wintry mix.”
However, di Nigerian Exchange Group for inside statement wey confam di death of di chairman for di accident don mourn di passing of di former CEO wey dem describe as a visionary leader.
“We dey deeply sad by di passing of our former Group Chairman , Bamofin Abimbola Ogunbajo, OFR.
“Im visionary leadership contribute well-well to shape NGX transformative journey, wey leave ogbonge legacy for Nigeria financial landscape.”
Nigeria President Bola Tinubu, politicians plus oda ogbonge Nigerians don pay tribute to Bamofin Abimbola Ogunbajo.
Who be Abimbola Ogunbanjo?
Di former President of di Nigeria Stock Exchange serve as President of di National Council of the NSE from 2017 to 2021.
Bamofin Abimbola Ogunbanjo bin also serve as di Group chairman of Nigerian Exchange Group Plc between 2021 and 2022.
Dem born am for Nigeria to di family of Chris and Hilda Ogunbanjo, OFR, CON, wey be ogbonge corporate lawyer, industrialist and philanthropist.
Abimbola Ogunbanjo get degree for Business Administration from di American College, Switzerland. LL.B. from di University of Buckingham, United Kingdom. E get Certificates for International Capital Markets and Maritime Law from di New York Institute of Finance and the University of Southampton.
Ogunbanjo be member of di International Bar Association, Nigerian Bar Association, Institute of Petroleum plus e be registered capital market consultant wit di Securities and Exchange Commission for Nigeria.
E serve on di boards of plenty multinational corporations and non-profit organisations, including Beta Glass Plc and di Advisory Board of di University of Buckingham Centre for Extractive Studies.
On 11 October 2022, former Nigeria president Muhammadu Buhari, give am National Honour of Officer of di Order of di Federal Republic (OFR), for im authentic contributions to di development of di Capital Markets, Corporate law and in recognition of im outstanding virtues and in appreciation of im services to Nigeria.
Rain, wintry weather condition, contribute to di accident – NTSB
Di National Transportation Safety Board (NTSB) one agency wey US Congress charge wit di responsibility to investigate every civil aviation accident across di United States of America tok say witnesses reports suggest say wintry weather condition dey among di factors wey contribute to di helicopter accident wey claim di lives of six pipo.
NTSB board member, Michael Graham say officials bin dey di scene to gada perishable evidence.
E say dem still dey investigate di accident and dem dey analyse di weather conditions at di time of di accident.
Oga Graham add say reports also suggest say fire occur wen di helicopter hit di ground.
“Di team methodically and systematically review all evidence and consider all potential factors to determine wetin fit cause di crash.
“Di crew consist of one one pilot in command and one safety pilot. The accident flight was operated by Na one Orbic Air LLC operate di flight wey crash as Part 135 charter flight.”
According to Graham, details on di passengers wey dey di aircraft no dey. E tok say “coroner office go release any names ,” e no give time frame.
E also add say di “helicopter no dey equipped wit cockpit voice recorder or flight data recorder. Dis helicopter no dey required to dey equipped wit those types of recording devices.”
Graham say di NTSB go look into di helicopter airworthiness; maintenance and structure of di helicopter, operations, meteorology, and air traffic control.
I beg Wigwe make e carry me follow body for im trips – Former Aviation Minister

As Nigerians still dey mourn di death of Access Holdings Chief Executive Officer, Herbert Wigwe, im wife Chizoba and son, tori of how one of im special assistant take narrowly escape di helicopter accident dey make round.
Local media, ThisDay Newspaper report say di Faleye Olushola bin fly wit Wigwe, im wife, son and former Group Chairman of Nigerian Exchange Group Plc (NGX Group), Abimbola Ogunbanjo from London, United Kingdom go Palm Spring, one city for California.
But wen dem reach Palm Spring, Olushola no gree board di helicopter wey dey go Boulder City for Nevada, sake of weather concerns.
Tori be say e choose to travel go Boulder City by road and na so e take escape di air disaster, wey claim di lives of odas.
One former Aviation Minister, Osita Chidoka, also tok how im beg di late Group Chief Executive Officer of Access Holdings PLC, Herbert Wigwe to carry am follow body for di journey.
Chidoka for one post on X on Sunday remember hin last moment wit di late banker and how im beg am to take am along im many trips overseas.
“I say, ‘Herbert, wetin dey pursue you, you travel a lot these days, biko take me along.’ E laugh and tok say, ‘Osita, you no fit keep up wit my pace. Just enjoy your peace.
“We laugh and say goodbyes. Na di last goodbye be dat.”
How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show