Site icon ilenkogossipparrot

Wetin we know about di Black Christmas for Plateau where jaguda pipo kill ova 70 pipo

About seventy pipo don die on Christmas eve for Bokkos and Barkin-Ladi local goment areas of Plateau State afta gunmen attack some communities from Saturday night till Sunday morning, local tori pipo Channels TV report.

Monday Kasa, di transition implementation committee chairman of Bokkos local goment area, tell tori pipo say di attack happun on Saturday till Sunday morning wen residents bin don dey for festive mood.

Di chairman tok say deadi bodi dey increase as security officials, hunters and vigilante group dey look bush to find pipo wey dey miss for di community.

Oga Kasa say di gunman set pipo houses for fire, damage dia tins and still come steal dia farm harvests.

Gyang Bere, di tok-tok pesin to Govnor Caleb Mutfwang of Plateau State inside on press statement say di govnor condemn wetin happun and call for community vigilance.

“Govnor Mutfwang don direct security agencies for di state security agencies make dem begin arrest di gunmen wey dey responsible for di crime and ensure say dem face di law,” di statement tok.

Di govnor also ask members of di communities make dem dey vigilant and report any criminal activities to security officials.

Govnor Mutfwang question di impunity of di attackers wey dey harm di communities and destroy pipo properties

Di governor wish di pipo wey wunjure quick recovery while im sympathise wit di pipo wey dia relatives don die for di attack.

“Govnor assure say proactive measures go dey available to reduce di ongoing attacks on innocent citizens. E sympathise wit victims families as im dey beg dem make dem find solace in God as di goment dey work to end di violence,” di statement tok.

“E reassure di public say dis goal remain top priorities, wit continuous efforts until dem achieve di desired results.

“As di state dey faces dis challenges, Govnor Mutfwang extend im prayers for peaceful Christmas celebration for Plateau and across di kontri.”

At di time of dis report, Alfred Alabo di tok-tok pesin for Plateau Police Command neva respond to calls and text messages.

How your favourite celebrities celebrate Christmas in fotos

Exit mobile version