• Login
ilenkogossipparrot
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
ilenkogossipparrot
No Result
View All Result
Home People

Wetin friends tok about man wey take im own life for Abia state afta e post about am

Sisi Eko by Sisi Eko
December 13, 2023
in People
0 0
0
0
SHARES
2
VIEWS
Share on FacebookShare on TwitterShare on whatsapp

Na on Tuesday, 12 December, na im one young man, Onoh Chukwuma Richard do a live video ontop im Facebook account.

E no tok anytin but reports say e bin don take di insecticide den. Di video no pass 20 seconds.

Not long afta, news break say di young man don take im life on Tuesday, afta im drink insecticide, for Umuahia, Abia State.

Now, some of im friends don tok on how di news shock dem, and how dem try to save di guy life wen e post a live video for im social media handle.

One of di friends wey no wan make we reveal im name tok say Chukwuma na aspiring politician wey dey work for some big politicians for Peoples Democratic Party (PDP), for Abia state

Im na one of di boys of di former Speaker of Abia state House of Assembly, Hon. Chinedum Enyinnaya Orji,” e tok.

“Wetin dey pain me now na how im mama go take handle di news of im death, because I know say im and im mama dey close well-well.”

According to im friend, Chukwuma bin dey get some financial challenges.

Anoda one say: “I know am very well, dat boy na my boy, e bin dey into dis changing of dollar business. E dey live for Umuahia. Di news pain me well well,” e tok.

For im last post on facebook on Tuesday, Chukwuma write say: “Today na my last day on earth! I dey go meet my maker.” E come mention names of some prominent Abia state citizens, and tok say “my spirit dey with you all”.

Abia State Police PRO, Geoffrey Ogbonna neva pick im calls to comment on wetin happun as at di time we do dis tori. Message wey we send give am neva get reply too.

Chukwuma describe imsef for im Facebook handle as a Director at Alwayzgood Exchange, but five days ago, e post one picture wia e describe imsef as “CEO of Faso Energy”.

Wetin go fit shele for house of assembly wey dey Rivers state 

Tags: Abia State
Sisi Eko

Sisi Eko

Related Posts

Lifestyle

‘My 17-year-old son die within six hours afta dem begin blackmail am with im fotos’

June 5, 2024
Nigeria

Light off, schools close, airports grounded as NLC strike witness ogbonge compliance

June 4, 2024
Nigeria

Na offence to refuse to sing di national anthem as a Nigerian?

June 4, 2024
Facebook Twitter Youtube Instagram
ilenkogossipparrot

We provide you with the latest breaking news and videos straight from the entertainment industry.

Follow Us

Category

  • News
  • Entertainment
  • Music

Recent News

Hunter Biden: US president Joe Biden only surviving son go go jail?

June 12, 2024

New minimum wage and oda highlights of Tinubu Democracy Day speech

June 12, 2024

Push for six-year single term for president, govnors – wetin lawmakers wan achieve

June 11, 2024

Plane wey carry Malawi vice president don miss

June 11, 2024

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Welcome Back!

Login to your account below

Forgotten Password?

Retrieve your password

Please enter your username or email address to reset your password.

Log In

Add New Playlist

No Result
View All Result
  • Home
  • News
  • Politics
  • Business
  • Entertainment

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Are you sure want to unlock this post?
Unlock left : 0
Are you sure want to cancel subscription?
Go to mobile version