Site icon ilenkogossipparrot

Wetin be di tori about Armed Forces Remembrance Day for Nigeria

President Bola Tinubu don lay wreath for di National Cenotaph Centre, Eagle Square, Abuja to mark di 2024 Armed Forces Remembrance day.

Di Armed Forces Remembrance Day celebration na annual event wey dey organized to honor members of di Nigerian Armed Forces and im veterans.

To mark di day, ogbonge events dey hold for federal, state and local levels.

Ova two months bifo 15 January, di ministry of Defence dey arrange one 25-man national planning committee to handle preparations.

Part of wetin dey shelle na military parades wey dey involve guard of honour from di Nigerian Army, Nigerian Navy, and Nigerian Air Force.

Wreath laying ceremony by di President of Nigeria for di National Cenotaph for Abuja Eagle Square na di top of di day event.

Authorities go also lay wreath for di 36 federal cenotaphs places wia special Armed Forces Remembrance Day ceremonies dey hold.

Nigerian Legion, wey be veterans association wey dey organize many events on dis day dey also receive ogbonge recognition.

15 January commemoration

Every 15 January Nigeria military dey gather to mark armed forces remembrance day.

Di day na one day wey dem set aside to celebrate military heroes for di Nigerian armed forces wey bin sacrifice dia lives for di nation.

15 January Armed Forces Remembrance day na also to celebrate military pipo wey dey war front for different places to protect di nation.

Di day also dey to honour old sojas of di World War I and II plus di Nigerian Civil War.

Nigeria wey be former British colony, bin dey celebrate dia Remembrance Day for 11 November togeda wit oda parts of di world as Poppy Day in honour of di end of di First World War.

But as di goment gain victory, against Biafran troops for 15 January 1970, dem move di holiday commot from di calendar of di Commonwealth of Nations.

So dem change am to 15 January to remember di conclusion of di Nigeria civil war wey bin wan tear di unity of Nigeria.

Some notable military officers wey die in di line of duty

Chief of Army staff Lt. Gen. Ibrahim Attahiru (2021)

Oga Attahiru and 10 oda officers die for plane crash as dem dey travel from Abuja to Kaduna state on official duty for May 2021.

Di tragic incident occur afta dem land for di Kaduna International Airport due to inclement weather.

According to di manifest, di passengers wey bin dey di aircraft na Chief of Army Staff, Lieutenant General Ibrahim Attahiru; acting Chief of Military Intelligence, Brigadier General Abdulkadir Kuliya; Chief of Staff to di late COAS, Brigadier General Mohammed Idris Abdulkadir; Brigadier General Olatunji Lukman Olayinka, Aide-De-Camp to di COAS, Major Lawal Aliyu Hayat, and Major Nura Hamza.

Odas include di pilots of di aircraft, Flight Lieutenant Taiwo Olufemi Asaniyi and Flight Lieutenant Alfred Ayodeji Olufade, as well as Sergeant Opeyemi Isaiah Adesina, Sergeant Umar Saidu and Aircraftman (ACM) Olamide Matthew Oyedepo.

Brigadier-General Dzarma Zirkusu

Brigadier-General Dzarma Zirkusu and three oda sojas pay di supreme sacrifice as dem dey fight against terrorists in Borno State of November 2021.

Zirkusu alongside some oda sojas die for ambush wey Islamic State in West Africa Province (ISWAP), a splinter group of Boko Haram sect lay for dem.

E bin be di Commander headquarters 28 Task Force Brigade, Chibok, Borno State before im death and na im be dis highest ranking officer wey don die since di right against di insurgents.

Lt. Col. Muhammad Abu Ali

For November 2016, di Nigerian Army mourn di death of di Commanding Officer of 272 Tank Battalion in Maiduguri, Lt. Col. Muhammad Abu Ali wey die for battle field.

Statement by di Theatre Command Centre of Operation Lafiya Dole for Maiduguri, say Ali, wey im nickname na Sarkin Yaki [dat is Chief Warrior], na di Commanding Officer 272 Task Force Battalion wey dey Mallam Fatori for Northern Borno.

Di Theatre Command say di officer die wey dem confront some suspected Boko Haram terrorists, wey bin attack di 119 Battalion, Nigerian Army location at Mallam Fatori in a failed attempt to capture di town.

Lt. Col. Ali bin don receive di Chief of Army Staff Award for Exceptional Bravery and Excellence and e don lead army units wey recover Gamboru-Ngala, Baga and several communities from terrorists and e die along with four oda gallant soldiers.

State by state judgement of di Supreme Court on top 2023 governorship election cases

Exit mobile version