Site icon ilenkogossipparrot

We feel betrayed’ – why pipo dey para for Senegal

Senegal be like who dey pass through identity crisis – di citizens dey proud of di fact say di kontri dey seen as one of di most stable democracies for West Africa but dem dey vex say dis reputation fit spoil.

One group of imams say, “we feel like Macky Sall don cheat us” for meeting wey dem hold for di capital, Dakar about di political kasala wey hit di kontri one week ago as lawmakers follow support President Sall choice to delay elections wey suppose hold dis month till December.

“Di president need to review am. E dey unacceptable”, na wetin Ismael Ndiaye wey be di general secretary for di Senegal League of Imams tok.

“E neva happun before. Senegal neva delay presidential election before. We feel betrayed. We feel misunderstood.”

Islam na di top religion for Senegal and tok from ogbonge Muslim leaders wey don chook mouth to solve political wahala before get plenti weight.

Di way wey dem no use two mouth tok show how pipo dey vex for di kontri sotay protesters don enta street.

President Sall tok say di reason im dey do am na because e need time to solve di wahala of who fit run as presidential candidate as plenti oppositions don dey blocked.

But for street, pipo dey see am as way wey Oga Sall go fit dey power afta im second term finish for 2 April.

For im first interview since im drop di announcement, President Sall say dat no be im intention.

E tell Associated Press ova di weekend say, “I no dey find anytin, I just wan leave a kontri wey dey in peace and stability. I no wan leave kontri wey go fall into crisis.”

But critics tink say na excuse, afta all, before im elections for 2012, na im hala against den President Abdoulaye Wade move to seek third term.

Oga Sall wey bin work as Oga Wade Prime Minister tok for im 2011 election campaign say, “President no fit extend im term for office. E no dey possible. E no fit push am even for one day, if not, di kontri go enta kasala because di pipo no go see im power as legal again.”

Violent protests don happun all ova di kontri in di last one week wey don kill three pipo.

Di first pesin wey die na student for di Gaston Berger University wey die for gbas-gbos with police for di northern city of Saint-Louis. Tori be say di second victim, na for di Pikine surburb for Dakar, dem shoot am. And on Saturday, hospital sources for di southern city of Ziguinchor (opposition stronghold) pronounce one 19-year-old dead.

For Dakar, na so so doti just fill di road afta gbas-gbos with security forces wey dey fire tear gas to pursue protesters.

Plenti pipo out of di four million wey dey live for di city dey vex for wetin happun.

We meet Fanta Diallo for road as she go buy provisions, even as tins get as e be.

“E pain me and I dey shame”, na wetin she tell BBC. “Dis one no normal. We no be monarchy. I enta town today so I fit buy everitin wey I need.”

Adamadou Baye wey follow im friend Aminata Issete comot for central Dakar sef gree.

“We need to protest jejely for wetin we belive dey right, but we need to do sometin. Me myself I dey vex well-well”.

Ms Isete bin shy to do di interview at first but she start to dey ginger.

“We don taya, we dey vex and dey very disappointed. Wetin dey do our kontri? Wetin dey work dat man?” She ask about di 62-year-old president.

“Why you no rate Senegal own citizens? We no deserve am. We wan vote new president”, na wetin she tok.

Defeated, disappointed, upset. Dat na wetin dem just dey tok for streets, for social media wia videos and pictures dey go round on top tori of alleged police brutality for di protests.

Dis na di young pipo wey dey vex say dem neva find work for di kontri and dey follow opposition leader, Ousmane Sonko wey dem don push comot from di presidential race say im get defamation conviction.

E don face plenti legal battles recently and don go jail for separate case say im call for insurrection, conspiracy with terrorist groups and endangering state security. All dis na for July wen dem ban im party.

Di 49-year-old still insist say all di charges dey politically motivated. Even as dem don move di elections to 15 December, e no sure say dem go allow am to run, but anyone im support fit get chance to win.

Na im stand on di economy wey don dey give Senegal elites sleepless nights but wey don give am plenti support. E don call out di kain close relationship di kontri get with dia old colonial powers wey be France.

Di former tax collector wan make dem comot from di CFA franc, wey be di regional money wey 14 African kontris dey use and wey dey pegged to euro under French goment guarantees. Pipo wey no like di plan say e go cause economic kasala.

Di next nine months fit give di weak ruling coalition opportunity to ginger dia chance for di election and to fit get stronger candidate dan di one Oga Sall pick, Prime Minister Amadou Ba, wey some pipo tink say no get charisma.

Di postponement fit also help anoda opposition leader Karim Wade, wey be di pikin of di former presido. E bin dey disqualified sake of say e no quick denounce im French citizenship, as di electoral laws no dey allow dual citizenship.

Goment tok tok pesin, Abdou Karim Fofana don insist say President Sall no fit doti im white for just few more months for power.

E tell BBC say, “wen you be leader, you to make unpopular decisions wey pipo sometimes no fit get. No be for pleasure na im make President Sall do so. E do dis one preserve im kontri sake of say im dey mature and responsible.”

With di amount of support wey Oga Sonko get plus di feeling say dem use di judiciary take chase am say make e no run for office, e no clear how dem go fit solve dis wahala.

Law sabi pesin El-Hadji Omar Diop tok say anoda situation fit happun.

Di university lecturer say, “President Sall fit step down, di day afta 2 April. Den na di National Assembly president go take ova power and call for new election within two to three months.”

More protests dey planned for Tuesday, although authorities neva approve am.

Mamadou Faye wey be papa of three dey hope say dia message go enta ear without more protests wey fit stop am to go work.

“No one go help me. We don taya for all dis. We just want make we fit feed our family.”

Who be Abimbola Ogunbanjo wey die wit Herbert Wigwe Access Bank CEO for helicopter crash

Exit mobile version