• Login
ilenkogossipparrot
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
ilenkogossipparrot
No Result
View All Result
Home Lifestyle Health

‘We dey like blind pipo’ – Di community for Enugu wia pipo dey live inside lack

Sisi Eko by Sisi Eko
May 13, 2024
in Health, Nigeria, People
0 0
0
0
SHARES
3
VIEWS
Share on FacebookShare on TwitterShare on whatsapp

Ugba Edogori Amorji Nike na small community for Enugu State, South East Nigeria.

Pipo wey dey dia na settlers from Ebonyi State, Ezeagu and Isi Uzo local LGAs of di state.

Di pipo bin settle for di area afta di Nigerian civil war. Some of di old pipo for di community say dem don dey for Ugba Edogori Amorji Nike since 1972

Di pipo for dia na mostly farmers wey dey live for small small mud huts.

Di community no get any basic social amenity. Pregnant women gatz travel several kilometers to born dia pikin, and many of di children for di village dey sick sake of di bad water wey dem dey drink from one stream for di village.

“Na divine help and traditional methods we dey rely on if woman wan give birth becos we no get any maternity facility for here,” Ngozi Anyamalu wey be woman leader for di community tell BBC Pidgin.

She also tok say dem dey find am difficult to feed sake of lack of farmlands for dem to cultivate.

Di Enugu state goment claim say di pipo of dat community na illegal settlers from Ezza for Ebonyi state.

E dey important to clarify say dis pipo na illegal immigrants wey go settle for dat place. To tok di truth, dis pipo na labourers wey dey move from one place to anoda dey find how to survive,” Aka Eze Aka, di Enugu state commissioner for Information tok.

Anoda resident of di community, Awu Chibueze, narrate how e lose im sight becos of disease wey e no know.

“Na farm work I bin dey do bifor I go blind. If we bin get hospital for dis community, my eye condition no for worse reach like dis,” Chibueze tok.

“I for go hospital dat early stage and maybe dem for give me treatment and di disease for go.”

Oga Chibueze now dey struggle to fend for imsef after im wife also die.

Chibueze story dey similar to dat of Ejiofor Anselm, wey dey permanently disabled afta e seek medical treatment from one unqualified nurse becos di village no get any health centre.

But despite im condition, Anselm say e still dey determined to kontinu im shoe making work if e fit procure di necessary equipment.

For December 2023, di govnor of Enugu State Peter Mbah bin tok say im administration go build 260 Primary Healthcare Centres for evri electoral wards for di state, promising to make sure say “evri child, mother, di elderly, and Enugu citizen get access to better healthcare”.

But promises like dis from Nigerian goment officials no be new tin.

“Dem dey usually come here to campaign for votes and promise us things, and after everithing, wen we vote dem into power, dem go forget us,” Cyprain Obasi wey be di community leader tell BBC News Pidgin.

“To di goment we just be like pipo wey don die.”

And as no school dey for di area to give di children access to formal education, Obasi say e be like say no hope dey to break di cycle of poverty.

Anoda community leader, Agu Charles, tok say dia major challenge na water.

E say dia major source of water for drinking and cooking na di Awuri stream wey no clean.

Enugu State get perennial problem of water supply even for di urban areas of di state. Successive govnors for di state don promise to solve di water issue but di problem persists.

Oga Eze Aka say di pipo no too sabi say pipo dey live for Ugba Edogori Amorji Nike or weda dem dey vote.

“Some of dem tok say goment dey forget dem afta dem don vote finish but we no sabi say dat kain place dey. Not even during campaigns.

E however assure say “di goment of govnor Peter Mbah dey determined to develop evri area of Enugu state to di level of agriculture. We get programs to ensure say pipo wey dey live for those kain places go benefit.”

Protest of electricity tariff hike from across Nigeria

Tags: Bad waterEnuguHealth issues
Sisi Eko

Sisi Eko

Related Posts

Nigeria

New minimum wage and oda highlights of Tinubu Democracy Day speech

June 12, 2024
Nigeria

Push for six-year single term for president, govnors – wetin lawmakers wan achieve

June 11, 2024
News

Labour unions outline grounds for suspending nationwide strike as dem tok wetin go happun next

June 5, 2024
Facebook Twitter Youtube Instagram
ilenkogossipparrot

We provide you with the latest breaking news and videos straight from the entertainment industry.

Follow Us

Category

  • News
  • Entertainment
  • Music

Recent News

Hunter Biden: US president Joe Biden only surviving son go go jail?

June 12, 2024

New minimum wage and oda highlights of Tinubu Democracy Day speech

June 12, 2024

Push for six-year single term for president, govnors – wetin lawmakers wan achieve

June 11, 2024

Plane wey carry Malawi vice president don miss

June 11, 2024

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Welcome Back!

Login to your account below

Forgotten Password?

Retrieve your password

Please enter your username or email address to reset your password.

Log In

Add New Playlist

No Result
View All Result
  • Home
  • News
  • Politics
  • Business
  • Entertainment

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Are you sure want to unlock this post?
Unlock left : 0
Are you sure want to cancel subscription?
Go to mobile version